‘My dream of lifelong marriage don go anoda direction’ – Mabel confam separation from AY

Di wife of popular ogbonge comedian Ayodeji Makun wey pipo sabi as AY comedian don finally come out to tok how her marriage wit her husband dey face serious gbege.

Mabel Makun say she don dey quiet sake of her children and her husband deserve privacy afta tori begin dey fly say she and AY don end dia marriage.

Both Ay and Mabel bin first dey silent about all di rumour wey pipo dey spread but e be like say no be wetin dem suppose keep shut about as dem both agree say na different lies pipo dey spread about dia marriage.

For 29 November 2023, both AY and Mabel celebrate dia 15 years of marriage and dem post am for dia social media page. E come shock pipo as di lovebirds end dia marriage just like dat.

According to di post wey Mabel Makun make, she reveal say her silence no be say she no sabi wetin she go tok ontop di matter but her silence na sake of di children and dia mental health.

‘I beg for privacy for me and my ex-husband’

Mabel say na different lies dem don cook ontop her head for social media but she prefer to honour her children and she no go tok anytin even as di marriage wey she don dream for long don take anoda direction.

She say her faith still dey bright for anoda future for herself and di children a she expect say all go go well.

“Make una no misunderstand my silence and also di father of my pikin wey I don live wit for some years deserve some kain level of respect and privacy from me and all di parties wey dey concerned.”

“Most importantly becos of our children wey we gatz take dia mental health and general well being serious.”

“My dreams of a lifelong marriage don take a different direction now, I dey committed to move forward wit grace and I get faith for a brighter future for both myself and di children. Ontop di whole rumors, I dey find comfort say all will be well,” Mabel post for her page.

She add say as tins end dey unexpected but she go step into a new chapter for her life and make pipo bin respect di privacy of she and her ‘ex-husband.’

Mabel say make pipo help her to create respect and understanding as she dey go through dis kain change for her life.

“Dis na challenging period, and I dey ask for privacy and consideration as my ex-husband and I) find our own path go anoda place. I dey wish him di very best for im own journey as well.”

‘Nobody dey innocent’ – AY comedian tok

For im own tok wey AY comedian drop for im Instagram, im reveal say all di parties wey dey involved for wetin happun for im marriage no dey innocent.

AY tok say no be say im no sabi wetin to tok becos im no dey weak but im get enough understanding to deal wit di issues.

Di popular host of AY live add say doz wey dey shook mouth for wetin no concern dem no go fit handle di issue but im no go entertain di public wit ‘personal family issues’.

“I don reach di stage for my life wey be say I no fit dey entertain di public wit deep personal family issues. I even get grown-up daughter wey get access to social media and we gatz protect her mental health so she no go see wetin she no go dey proud of for online,” AY post.

AY agree say true true im don do tins wey im no dey proud of but im no compromise im own family.

Di comedian say na one tin to ‘watch im friendship/ marriage of 20 years slip comot for im my hands, but na anoda tin make some pipo wey dey involved dey put blame for di space wey women dey always win as a victim.’

“I fit tell you for free say no one dey completely innocent enough to to throw stones. Even as I dey love di lies wey dey spread about everytin ontop blogs, my own truth go still later catch up,” AY post.

Bifor di two of dem bin end dia marriage, dem still dey go different events togeda wey dem splash di fotos ontop dia social media platforms, including di Merry Men 3.

For 2022, AY Comedian and im wife, Mabel born dia second pikin.

Di comedian na im announce di tori for social media say dem born 13 years afta dia first child Michelle.

Who be AY Makun?

AY Makun na comedian wey blow for di industry wit di release of im stand-up comedy show wey im call AY Live wey start for 2010.

AY also get TV drama series like AY’s Crib and The AY Show.

Howeva no be until 2015 e start to dey produce im own feem with 30 Days in Atlanta.

Oda feems wey e don produce include 10 Days in Sun City, A Trip to Jamaica and Merry Men.

E don follow plenti celebs work including Ramsey Nouah, Funke Akindele, Jim Iyke and international stars like Vivica Fox.

Some celebrities wey dia relationship/marriage crash

Bolanle Ninalowo and wife

Dis one bin make fans dey speechless wen tori begin trend say di 17-year-old marriage of popular Nollywood actor, Bolanle Ninalowo, and im wife, Bunmi, don end.

Oga Ninalowo bin tok for im Instagram handle last September.

Di actor bin add say di split be di best for both parties.

Dis no be di first time wey di couple marriage mata go enta news say dia marriage don end.

For 2017, actor, Ninalowo bin tok for one interview say afta12 years togeda dat year, e and im wife don decide to end tins. Dey later reunite for 2018.

Dj cuppy engagement/ separation

Popular Disc Jockey Florence Otedola aka DJ Cuppy separate from her fiancé Ryan Taylor.

For one tweet for July 2023, Di popular DJ bin confam say her and her British boxer partner don separate.

Dia engagement bin shock many Nigerians dat time as some of her fans bin tok for social media dat time.

DJ Cuppy and Taylor bin engage for 2022.

Yomi Gold

Yoruba movie actor and producer Yomi Alore aka Yomi Gold bin announce end of im second marriage to im wife, Meenah for January 2023.

Di actor wey im real name na Yomi Alore say dem decide to go dia separate way as love don die for dia relationship.

Dia separation bin shele barely one year afta dia marriage.

Yomi wey announce di end of dia marriage on im verified Instagram account say na di two of dem decision and e want make dia families understand.

E bin post say “Wen love die for relationship, make nobody force am.”

Faridah Sobowale

Popular Lagos State socialite, Farida Abdulkabir aka Farida Sobowale, two-month marriage bin crash for August 2023.

For one voice note wey bin go viral for social media, Farida bin tok say her N100 million marriage wit anoda Lagos socialite, Demola Okulaja, crash afta two months.

Israel DMW/ Sheila

Music star Davido logistics manager, Israel Afeare aka DMW and im wife Sheila marriage crash dis year too. E no clear wen but e reach social media wen dem two come online to tok about am.

Canadian Prime Minister, Justin Trudeau and wife separate

For August, Canada Prime Minister Justin Trudeau announce separation from im wife Sophie.

Trudeau and im wife Sophie dey separate afta 18 years, following “meaningful and difficult conversations.” di PM post for im social media account.

Dem bin marry for Montreal for 2005 and get three children togeda.

For one statement, Oga Trudeau office tok say although di couple don sign separation agreement, dem go still dey make public appearances.

Source