Tori say UAE lift visa ban on Nigerian travellers na lie

Di Nigeria goment don deny di claim say United Arab Emirates don lift visa ban wey dem impose on Nigerians wey wan travel go dia kontri.

For October 2022, UAE ban Nigeria and 19 oda Africa kontris in relations to immigration issues. .

Bayo Onanuga, one of di tok tok pesin for president Bola Tinubu say United Arab Emirates neva start to dey issue Visa for Nigeria travellers.

Oga Bayo explain say di document in circulation wit di title ‘Joint Announcement by di goment of Nigeria and di UAE on 4th March, 2024’ no be di Nigeria goment or UAE goment issue am.

Di goment dey debunk di information afta some media organisation and social media handles don publicly share di information.

Di document wey dey circulate ontop social media say di goment of Nigeria and goment of UAE don announce new development in dia diplomatic relationship for di resumption of visa services for Nigerian citizens wey wan visit UAE from 4 March.

“Dis achievement follow di discussions between im excellency president Bola Ahmed Tinubu of Nigeria and im highness Sheikh Mohamed bin Zayed Al Nahyan, president of di United Arab Emirates, mark significant step forward in our bilateral cooperation,” di statement tok.

According to di document pipo fit vist Document Verification Hub platform to verify dia documents for visa applications.

However, wen BBC Pidgin bin visit di website page, e no dey provide any valid information; “Coming soon. Our easy platform dey ensure easy documentation verification and delivery of your document verification code, fast-tracking your visa application to di Middle East.”

Dis no be di first time wey false information on di lifting of restriction wey UAE impose on Nigerians visa documents go circulate ontop social media.

For September 2023, Ajuri Ngelale issue statement ontop im social media page say di kontris don agree to lift ban on Nigerians visa afta di president Bola Tinubu meet wit di UAE president, Mohamed bin Zayed Al Nahyan on 11, September 2023.

But di UAE goment on dia website debunk di information, e tok say both kontris leaders explore opportunities for bilateral collaboration wen dem bin meet but dem bin no make any arrangement on removal of visa restriction.

Aviation drama between UAE and Nigeria

Many disagreements dey ground between both goments and na di aviation sector suffer am di most.

For December 2021, Nigerian goment reduce di number of Emirates Airlines flight operations for Nigeria from 21 flights to one flight per week.

Di decision wey di goment say na to retaliate against di way di UAE goment take treat one local carrier, Air Peace.

Di UAE bin reduce Air Peace operations from 3 flights to one per week.

Di decision by di Nigerian goment force Emirates Airlines to stop operations for Nigeria for few weeks.

Operations later kontinu afta both goment settle.

For August 2022, Emirates Airlines announce suspension of all flight operations for Nigeria wit effect from 1 September.

Dem say di reason na dia inability to collect dia money wey dey trapped for Nigeria.

For August 2023, president, Bola Tinubu, don promise di citizens dem go soon resolve di dispute but since den di visa ban still dey in place.

Source