How helicopter wey carry Wigwe, wife and son crash – Report

Pipo see di helicopter wey bin carry three Nigerians and odas for California as “fireballs” before e crash and claim di lives wey dey inside, di US National Transportation Safety Board (NTSB) tok for dia preliminary report.

Group Chief Executive Officer (GCEO) of Access Holdings Plc, Herbert Herbet Wigwe, im wife, im son, former Group Chairman of Nigerian Exchange Group Plc (NGX Group) Abimbola Ogunbajo na di Nigerians wey die for di crash.

Di Airbus Helicopters EC 130B4 wit registration number N130CZ wey crash near Halloran Springs, California for 9 February, 2024 also claim di life of di pilot plus di co-pilot.

According to di NTSB, di witnesses report say di weather on di day di accident happun na a mix of rain and snow.

Di report also tok say di automatic dependent surveillance broadcast (ADS-B) technology dem build for di helicopter wey dey provide di position of an aircraft, bin record increase in ground speed before di crash.

“According to law enforcement, several witnesses wey dey travel inside motor call 911 to report say dem observe one ‘fireball’ to di south.

“Di witnesses bin report say di weather conditions for di area “no good” and di rain wey dey fall bin dey mixed wit snow.” Part of di report tok.

Di NTSB further state say dem “locate di wreckage for one high mountainous desert and parts of di helicopter scata everiwia sake of di impact of di hit.”

Di report add say dem find all major components of di helicopter for di site of di accident.

“Di fuselage bin dey fragmented, di cockpit and cabin dey destroyed. Some debris and vegetation show thermal damage.

“Di flight control tubes and linkages wey lead up to di flight control servos dey fragmented and dem no fit verify continuity.

“Di main motor blades scata and di blade sleeves and tips bin dey present,” di report tok.

We dey update dis tori. Refresh your browser.

Source