Wetin dey happun wey make citizens dey protest against USA, France for DR Congo

Di M23 rebels na di group wey don face accusations

AFP
Di group dey make up of soldiers from Kenya, Burundi, South Sudan and Uganda

Serious protest don dey happun for di Democratic Republic of Congo protest against foreign kontris wey dem allege say e dey control dia mineral resources.

Di protester bin block di UK embassy for Kinshasa. Dem dey accuse say US, France and UK bin dey back Rwanda for di war crimes wey dem don commit.

For di video wey spread for social media, di protesters bin block di entrance of UK embassy wit tyres as dem dem burn fire for di road.

Bifor, DR Congo, di UN and di United States don accuse Rwanda say dem send dia soldiers to fight for eastern DR Congo alongside M23 rebels.

Di M23 rebels na di group wey don face accusations ontop say dey carry out war crimes against civilians.

Di fighting for minerals- lithium, kontinu and na di innocent civilians for DR Congo dey affected pass.

Plenty armed groups wey include di notorious M23 rebels don lay siege around DR Congo to take control of am sake of say dem dey rich in mineral resources.

Di violence wey dey happun for di eastern part of di DR Congo don take many years now as thousands of pipo don begin comot for di kontri and plenti pipo don die as a result of di conflict.

Rwanda bin deny say dem no dey back di M23 rebels. But dem also tok say di Congolese authorities don fail to collect arm comot for di hand of di ethnic Hutu rebels wey some don dey linked to di genocide wey happun for Rwanda in 1994.

Di M23 dey even defend diasef say dem dey defend dia own ethnic group wey be Tutsis, against di army of Hutu wey Congo goment dey support.

Ontop all of dis crisis, DR Congo and Rwanda no dey in peace wit each oda- and both of dem dey blame each oda for di crisis wey dey happun.

Di conflict between di different groups bin lead to di death of atleast 60 civilians during di attacks for October 2023. UN tok say ova 6.9 million pipo don dey pushed to run comot for dia homes in DR Congo.

UK embassy condemn di crisis for DR Congo

Di British embassy for Kinshasa don react to di ongoing crisis DR Congo and how e dey spread for di region.

For di statement wey di embassy bin release on Friday 9 February 2024, dem tok say di UK dey concerned about di consequences of di conflicts on citizens of Congo.

Di embassy dey disturbed by di tori of “ova 135,000 pipo wey no get house again sake of dis crisis and thousands don run comot for dia home.”

“We condemn di violent offense of M23 and actions of oda illegal armed groups wey dey eastern DR Congo and dey cause suffering for innocent civilians.”

“Di United Kingdom go support all parties wey go work towards dialogue and return peace to di region,” di statement tok.

Wetin be di M23 group?

Di M23 group dey around for ova a decades now (10 years) wey UN tok say na Rwanda wey be neighbour to DR Congo bin form am afta a peace deal bin dey difficult.

Di group come back few years ago and dem don take ova a large part of North Kivu (DR Congo town) wia dem don cut di crops comot.

Source