Who be di South African lawmaker dem suspend for using racist language and wetin e tok

One South African lawmaker don chop suspension from im party, di Democratic Alliance (DA), afta series of old of clips resurface on online as e dey use violent racist language against black pipo.

Renaldo Gouws bin tok say one of di videos dey doctored and deny am but one statement issue by di DA on Thursday tok say, e dey “genuine and no be fake”.

Inside di video, Mr Gouws wey dem swear into parliament last week, use local slur wey typically dey reserved for Black Africans repeatedly along wit di n-word, and tok say make dem kill black pipo.

Dis move dey bad for President Cyril Ramaphosa as e just form new coalition government wit di DA.

Afta dem swear am in for a second full term as president on Wednesday, e don agree on di distribution of ministerial posts between im own African National Congress (ANC) and di DA, along wit three smaller parties.

Di ANC fail to win majority for last month election for di first time since di end of di racist system of apartheid for 1994.

Di centre-right DA, di kontri second-biggest party, don face accusations of racism from critics wey say di party wan protect di interests of di white-minority population – e deny di charge.

Di DA don tok say Oga Gouws go face “disciplinary charges”.

Earlier dis week, anoda old video clip show face, wia Mr Gouws bin make racially charged remarks.

Inside di di video, e imply say white pipo dey subjected to reverse apartheid.

E tok say: “If Africa go disappear off di face of di earth, no one go notice”.

More dan 40,000 pipo don sign online petition wey dey call for im removal as MP.

On Monday, afta di first clip bin come out, di 41-year-old claim say e no dey racist and apologise ontop X, as im say, e tok in a “crass” and “hostile” way.

“I deny any claim of racism or being racist. I don howeva see how my message take dey in di way I deliver am and I take full responsibility for di actions of my younger and immature sef,” e tok.

DA leader John Steenhuisen bin defend Oga Gouws, but e neva dey clear if e don see di latest video wia Oga Gouws tok say make dem kill black pipo.

Senior DA official and former party leader Helen Zille on Wednesday tell local media say: “Such language dey unjustifiable and unacceptable. I no see how such offensive language fit dey justified.”

Oga Gouws na former councillor for Nelson Mandela Bay ward two and popular figure on social media, wey dey always stir controversy.

Di South African Human Rights Commission (SAHRC) tok say dem go take legal action against Mr Gouws “for di alleged racial utterances relating to online media posts”.

Inside one statement wey dem share on X, di SAHRC conclude say di comments by di lawmaker dey “constitute hate speech and/or harassment”.

“Based on Oga Gouw position as Member of Parliament, im alleged actions carry even greater weight and responsibility.”

Di coalition between long-time rivals di ANC and DA, wey dem dey officially call Government of National Unity, don dey harshly criticised by some since dem make di announcement last week.

Julius Malema, leader of di Economic Freedom Fighters (EFF), wey form di party afta e bin leave di ANC for 2013, condemn di agreement.

“We no agree to dis marriage of convenience, to consolidate di white monopoly power ova di economy and di means of production for South Africa.”

Former President Jacob Zuma and founder of uMkhonto weSizwe (MK), wey be di third position in di recent election, share di same sentiments.

E tok say goment of national unity no dey for South Africa and e describe di partnership as “white-led unholy alliance between di DA and di ANC of Ramaphosa”.

South Africa business community don broadly welcome di coalition goment, hoping say e go provide economic stability.

For im inaugural speech, President Ramaphosa promise to deliver economic growth, provide jobs and reduce inequality in di kontri.

Graphic showing make-up of new parliament

BBC

Profile of Renaldo Gouws

Renaldo Gouws na South African politician, and industrial psychologist. E hold Master Degree in Industrial and Organisational Psychology, and na Member of Federal Council for DA in di Eastern Cape.

E start im political career as branch chairperson, for Ward 2 for Nelson Mandela Bay for 2012. Gouws serve four year term as di chairperson, and acting ward councillor.

For 2016, e rank high on di PR list for di DA to secure seat, for di Nelson Mandela Municipality Council. In 2019, dem elect am as DA councillor for Ward 2 inside by-election wia plenti pipo vote for DA.

From 2019, Gouws serve as di tok-tok pesin for Economic Development, Tourism and Agriculture for DA for Nelson Mandela Bay.

Source