Paul Biya coronavirus speech: Seven tins di Cameroon president tok for e Covid-19 broadcast

Dis goment afta deh elect e for rule for anoda seven year

Getty Images
Dis goment afta deh elect e for rule for anoda seven year

Cameroon President Paul Biya tok for e kontri pipo today.

For e speech e say make kontri contribute for solidarity fund and also sorry message for families weh dia pipo die.

For dis unity evening, context bi different and na why dat ah di address wuna, e no bi possible for maintain celebrations for seka dis sick.

See de seven key tins for inside e Covid-19 unity speech.

  • Make population no panic, no listen to fake news de challenge big.
  • Put aside political divide for join de fight and e thank parties partners, Jack Ma, Alibaba group weh de support Cameroon for fight Covid-19. President Biya Invite political parties, associations for invest for fight covid-19 di respect rules weh goment put ground.
  • Sorry message for families for pipo weh deh die.President Biya send sorry messages for families weh de loss pipo, encourage pipo weh deh dey hospital and hail medical team.
  • Make pipo no use Covid-19 for make profit.Goment go fight pipo weh deh wan use de Covid-19 for make social, political and economic gains and make de pipo weh deh test positive for respect confinement. And e call pipo for continue for put moni for solidarity fund, thank pipo weh don contribute.
  • How Covid-19 di affect economy.President Biya tok about de negative economic impact, and need for keep jobs, and instruct goment for ensure social peace.
  • Solidarity Fund.President Biya call an all for contribute for solidarity fund and thank pipo weh deh don already contribute.
  • Respect barrier measures President Biya call population for respect protection measures, plenti don bi implemented, but as de pandemic di increase need bi for adjust. Ah di call on Cameroonians for get confidence for goment as deh go take all necessary measures, if drug komot, goment go do all tin for give’am for kontri pipo.
  • Stop for stigmatise.President Biya say make kontri pipo stop for stigmatise de pipo weh deh get Covi-19. We get for put more effort for fight Covid-19, we get for remain united and ah di call all man for join dis fight Covid-19. E encourage search for herbal merecine.

Cameroon President Paul Biya address e kontri pipo as kontri di mark 48 years wen de two sides, Southern Cameroons and French Cameroon join as one kontri.

For May 20, 1972, de two unit join as one but tomorrow, public celebration no go dey, for seka Covid-19.

Na de second taim for history weh Cameroon no go celebrate dis unity day, de first taim na wen army bi wan take over kontri by force for 1984.

E happen say na de first taim since weh Cameroon confirm first case Covid-19 enta kontri for march 6.