Wetin we know about di alleged murder-suicide case involving popular business man Sesan Adelabu and im wife for Ondo

File foto collage of woman wey put hand for head and crime scene tape

Getty Images
Adelabu allegedly cut im wife wit cutlass

Police for Ondo state say dem don begin investigation into wetin make one popular businessman for Ondo, Sesan Adelabu allegedly take im own life afta e murder im wife for dia house.

Na on Friday evening tori bin comot say Adelabu allegedly cutlass attack im wife before im come kill imsef by drinking a poisonous substance for di same house wey dem dey live.

Di incident wey happun for Alagbaka area of Akure, di Ondo state capital don begin dey generate plenti tok-tok sake of say di husband na popular businessman wey own ‘Emirate petrol station’ for di same city.

Na for ground dem meet Adelabu wen dem go check am wit a bottle of di deadly insecticide wey police tok say e be like say na wetin im drink to take im own life be dat.

According to police tok-tok pesin for Ondo state Funmilayo Odunlami-Omisanya, di commissioner of police don take di mata serious and im don order di homicide section of di state CID to takeova di case of di alleged murder and suicide.

For di video wey spread for social media, Mrs Bolu Adelabu wey be di wife of di popular businessman bin get different machete cuts for her body, her head and face.

Dem meet di lifeless body of di wife for dia matrimonial bed wit blood all ova, but di husband body bin dey beside di toilet – dia dem find im own lifeless body for ground.

Police say na di officer wey dey attached to di businessman bin first discover di issue.

“Di officer wey dey attached to di house of di man wey die bin receive call from di child of di dead couple around 6:00pm wia im dey ask of im papa sake of say im no dey pick calls. As di police dey try confam wia im oga dey, na wia im see di deadi body of im oga lifeless for ground in di toilet.”

“Di lifeless body of di wife bin dey ontop bed wit multiple cuts wey we suspect say na from di cutlass wey di husband use cut her on di head and face,” police tok.

Police tok-tok pesin Odunlami add say serious investigation don begin to find out all di circumstances wey lead to di unfortunate incident.

Di deadi body of di husband and wife don dey deposited for hospital morgue.

Source