You gatz add salt to make di perfect cup of tea?

Tea for inside cup

Getty Images

Di British dey claim say na dem sabi wella wetin e go take to make beta cup of tea.

As for di UK, tea don turn dia culture as dem dey drink about 100 million cups daily.

But now one scientist all di 5,000km way from US dey claim say e fit make beta cup of tea with wetin pipo go tink no go make sense, e want make we add salt.

Prof Michelle Francl research don dey cause kasala for UK and don even make di US embassy to chook mouth for inside di mata.

Di embassy tok for X say, “we wan assure di good pipo for UK say di notion of adding salt for Britain national drink no be official United State policy. An e no go ever be.”

No be di first time tea go cause kasala between di two kontris.

For 1773, protesters for Boston inside colonial Massachusetts throway 300 chests wey bin dey full of tea enta water to protest British taxes.

Dis na di ogbonge moment wey start di American Revolution.

Prof Francl wey be professor of Chemistry for Bryn Mawr college for Pennsylvania tell BBC say, “I bin no try to cause diplomatic kasala. My emails don dey go crazy today. I bin no expect say I go wake up to see pipo dey tok about salt for dia tea.”

So wetin go make pesin add salt?

Apparently no be new idea. Dem even add am for Eight Century Chinese manuscript. Dis na di same informate Prof Francl use tale perfect our recipe.

She say, “wetin dey new na how we take understand am as chemists.”

Prof Francl explain say salt dey block wetin dey cause us to taste di bitterness for tea especially if dem stew am.

If you put pinch of table salt, wey you no even fit taste, e fit change di bitterness of di drink.

“No be like pesin wey add sugar. I think pipo dey aftraid say dem go taste di salt.”

She want make tea loving Brits get open mind before dem judge her research.

Dem document am for her new book wey she call Steeped: The Chemistry of Tea wey dem published by di Royal Society of Chemistry.

She say, “e dey OK to experiment. I do di experiments for my kitchen for dis, to channel your scientist.”

Prof Francl don love tea since she be 10 years old wen her mama make am her first brew.

Everybodi get wetin dem tink say dey make di best cup of tea but Francl suggest using tea leaves for inside cup in stead of di tea bag and to continue to dey stir an so di tea go get beta exposure to milk and water.

She add say if you squeeze small lemon juice put inside e fit comot di doti wey dey float sometimes for di surface of di drink.

oda suggestions wey she get na to use short mugs so di tea go dey hotter. To also warm di tea and milk but only add di milk afta yiu make di tea.

But di oga of all her advice na make you no warm di water for microwace, because “e dey less health and no go taste good”.

Prof Francl say, “you go get tea scum for di surface wey get all di antioxidants and taste compounds.

“While UK no go take sabi dis method of tea making, e dey common for US.

“I don get beta tea for service stations for Ireland pass sone fancy restaurants for US.

“I think say na just because pipo no know, if you no dey drink tea, you no go know say you dey make yeye cup of tea give pesin.”

She say she like to dey go UK wia she know say she go get beta cup of tea.

So wetin go happun to Britain and America tea relations.

Di US embassy say dem no go follow Prof Francl advice and go continue with wetin dem call di proper way to make tea, wey be to put am inside microwave. While di UK Cabinet Office don match leg for ground say dem fit only make tea wit kettle.

Source