How to take care of your skin during harmattan

How to care for your skin take care of your skin during harmattan

BBC

Harmattan and one thick oil cream bin dey trend ontop X formerly twitter, and di question wey pipo dey ask na if oil cream dey help prevent dry skin during harmattan season.

Dis na as harmattan showface for Nigeria and West Africa and e dey affect pipo in different ways.

Harmattan na change of weather condition wey dey usually happun from di end of di year to di first quarter of a new year.

E dey come wit dry breeze, hot sun wey dey cause serious heat, and dust.

For early hours of di day weather go dey cold. Harmattan dey make some pipo nose, mouth, lip, legs and skin to crack anyhow.

Some pipo eyes go dey bring out water sake of dust.

Some pipo don begin wear facemask dey waka sake of dust wey full evriwia due to harmattan.

Wetin Harmattan be?

According to sabi pipo harmattan na hot dry wind wey dey blow from east side for di sahara.

As di wind dey blow, e dey carry plenty dust wey go full air sotay you fit no see your front sef.

So harmattan get as e dey change weather and e dey affect pipo health?

Even though some pipo dey enjoy di cool breeze in di morning, and pipo clothes dey dry sharp sharp, harmattan disadvantage na di way e dey affect pipo health.

BBC Pidgin tok to Doctor Enu Timipre wey be skin doctor (dermatologist) im dey work for hospital.

How to protect your body during Harmattan

Pipo get to look for ways to protect dia sef during Harmattan season. But no be evri type of tin fit protect your health, especially your skin.

Dr. Enu Timipre wey dey word for Dermatology department, Federal Medical Centre , Yenagoa, Bayelsa state, highlight different ways wey pipo go take protect dia skin for di Harmattan season.

1. Adequate hydration: E mean say make pipo drink plenti water evritime.

Make sure say you no stay for long without water, sake of say your skin di water wey you dey drink to maintain e freshness.

2. Protective clothing: Make pipo try wear clothes wey go protect dia body” dis no be di time wey pipo go dey expose dia skin sake of di harsh weather im tok

E say even though di weda dey hot make pipo pity dia skin too.

3. Use Sunscreen: Sunscreen na di name of cream wey pipo dey use to protect dia face or skin from sun burn on a daily basis weda harmattan dey or not.

Na pipo wey get money dey use am well well as no be evribody fit afford am. Sunscreen dey cost between 10 to 20 thousand naira and even more, depending on di product, quality and quantity.

4. Vaseline: Vaseline na good moisturiser too and Dr Enu explain say “pipo wey no fit afford Sunscreen fit use Vaseline in place of suncreen sake of say na effective mosturiser, and e dey readily available and cheap”.

5. Bathing with lukewarm water: “If you still dey baff wit hot water or cold make you stop am” Dis na wetin Dr. Enu emphasis. E explain say “cold water go make di skin shrink and e go make di body to try protect imsef, and e go make di skin dry more and more.

Dis dryness fit cause itching, body go dey scratch you anyhow and oda effects of cold.

6. Lip and Feet: E say make pipo use Lip gloss or Vaseline to prevent dia lip and feet from crack.

Oda effects of Harmattan

  • Harmattan fit worsen oda existing skin conditions and even provoke allergies.
  • Generally e dey affect di respiratory system sake of dust and cold wey dey cause running nose.
  • Pipo wey get respiratory (breathing) diseases like asthma go get frequent attacks and e advise make dem always carry dia inhaler dey waka.
  • Cough and catarrh go affect pipo well well especially children, parents and guardians need protect dem.
  • Make pipo try not to expose demsef to cold and dust and hot sun especially for di peak period.

Source