Wetin friends tok about man wey take im own life for Abia state afta e post about am

Na on Tuesday, 12 December, na im one young man, Onoh Chukwuma Richard do a live video ontop im Facebook account.

E no tok anytin but reports say e bin don take di insecticide den. Di video no pass 20 seconds.

Not long afta, news break say di young man don take im life on Tuesday, afta im drink insecticide, for Umuahia, Abia State.

Now, some of im friends don tok to BBC Pidgin on how di news shock dem, and how dem try to save di guy life wen e post a live video for im social media handle.

One of di friends wey no wan make we reveal im name tok say Chukwuma na aspiring politician wey dey work for some big politicians for Peoples Democratic Party (PDP), for Abia state.

“Im na one of di boys of di former Speaker of Abia state House of Assembly, Hon. Chinedum Enyinnaya Orji,” e tok.

“Wetin dey pain me now na how im mama go take handle di news of im death, because I know say im and im mama dey close well-well.”

According to im friend, Chukwuma bin dey get some financial challenges.

Anoda one say: “I know am very well, dat boy na my boy, e bin dey into dis changing of dollar business. E dey live for Umuahia. Di news pain me well well,” e tok.

Chukwuma last post before im death

For im last post on facebook on Tuesday, Chukwuma write say: “Today na my last day on earth! I dey go meet my maker.” E come mention names of some prominent Abia state citizens, and tok say “my spirit dey with you all”.

Abia State Police PRO, Geoffrey Ogbonna neva pick im calls to comment on wetin happun as at di time we do dis tori. Message wey we send give am neva get reply too.

Chukwuma describe imsef for im Facebook handle as a Director at Alwayzgood Exchange, but five days ago, e post one picture wia e describe imsef as “CEO of Faso Energy”.

Source