NCAA begin investigation into United Nigeria airline

Di Nigeria Civil Aviation Authority (NCAA) tok say dem don begin torchlight di condition wey make one domestic airline, United Nigeria airline NUA 0506 land for Asaba, Delta state instead of di kontri capital, Abuja.

Dis dey contrary to di tori wey dey fly up and down say NCAA don suspend all di wet-leased aircraft wey dey under di airline.

Di Director General of NCAA Musa Nuhu for inside statement tok say dem dey investigate wetin make di airline divert passengers go Asaba International Airport instead of Nnamdi Azikiwe International Airport (NAIA), Abuja plus di confusion e don cause for di kontri.

PRESS RELEASE

NCAA COMMENCES INVESTIGATION INTO UNITED NIGERIA FLIGHT

The Nigeria Civil Aviation Authority (NCAA) have…

Posted by Nigeria Civil Aviation Authority on Monday, November 27, 2023

Na passengers wey board di United Nigeria airline NUA 0504 on Sunday enta social media to complain say di pilot land di plane for Asaba and cabin crew announce say dem don land Abuja.

Dis mata don generate plenty tok-tok for social media and e raise question about wetin happun recently about how airplane take skid off di runway for Port Harcourt International airport Omagwa.

Although di United Nigeria Airlines don apologise for wetin dem call misunderstanding on dia Lagos to Abuja flight.

For inside one statement by di airline tok-tok pesin, Achilleus-Chud Uchegbu, e explain say di pilots of di aircrafts temporarily divert di flight go Asaba airport sake of “poor destination weather”.

“At all material time, di pilot of di aircraft bin dey aware of di temporary diversion and e dey properly briefed.

“However, wrong announcement by di cabin crew wen dem land safely for Asaba bin create confusion among di passengers.” Di airline tok.

Source