How Israel Adesanya lose UFC middleweight title fight to Sean Strickland

Adesanya lose UFC middleweight title fight

Getty Images

Sean Strickland don shock Israel Adesanya and di mixed martial arts world.

Di American drop Adesanya in di first round and just dey beat am dey go.

Strickland serve Adesanya wit constant pressure and steady upright boxing to deliver a unanimous decision victory over Israel Adesanya.

Di American don become di new middleweight world champion in di UFC 293 headliner Sunday.

Judges all score di fight 49-46 for di Qudos Bank Arena in Sydney, New South Wales, Australia.

Bifor di fight Adesanya bin see imsef as pesin wey no get level against im opponent Sean Strickland.

Dis na the last stylebender 11th title fight in five years and na strong favourite against American Strickland.

But di New Zealander say Strickland dey “dangerous” and I’m no go underestimate am.

Last last Strickland shock im opponent Adesanya for Sydney.

“I dey dream? I go to wake up? Somebody hit me. Oh my God guys. Literally, never in a million years I ever think am say I go dey here,” Strickland tok.

Israel Adesanya v Sean Strickland

Getty Images
Israel Adesanya get 24 wins and just two losses on im MMA record

Strickland bin don already tok anyhow about Adesanya during di build-up, as im claim say im punch one of im fans “for mockery” wen im land for Australia earlier dis week.

As di second best and fifth-ranked middleweight wey dey enta di fight, Strickland catch Adesanya attention during di first round wit a left-right combination, wey split “The Last Stylebender” guard and drop am wit a kick.

Dat one pain Adesanya well- well even turn im back to Strickland, wey give am chance to knack Adesanya till di end of di first round.

Di American almost finish di fight dia but im no get chance to hit dat knockout punch.

Na from dia Strickland kontinu to mount pressure dey beat Adesanya dey go.

Dat constant pressure worry Adesanya well-well sotay e no fit find balance again till di fight end.

Source