Di Dukes of Cambridge and Sussex unite to unveil one statue of Diana, Princess of Wales, as dem say “every day we wish say she still dey here with us”.
William and Harry come together for one ceremony for Kensington Palace Sunken Garden wey dem bin redesign, on on day wey suppose be dia mother 60th birthday.
Na dia first appearance together since di Duke of Edinburgh burial for April.
- Diana: Di Princess wey love Africa
- Princess Diana: Martin Bashir BBC interview controversy – Wetin e dey about?
“We remember her love, strength and character,” dem tok.
“Qualities wey make her a force for good around di world, as she change countless lives for di better.”
Dem say dem hope say di statue go “dey seen forever as symbol of her life and her legacy” and dem thank “all those around di world wey keep our mother memory alive”.
William and Harry commission di statue for 2017 on di day wey mark di 20th anniversary of dia mama death on 31 August 1997.

Where and when di unveiling happen?
Di statue dey unveiled on Thursday 1 July for di Sunken Garden for Kensington Palace.
Kensington Palace say di Sunken Garden na one di locations wey di Princess bin like pass, during di time she live dia with Prince Charles.
More dan 4,000 flowers na im dem don plant for di redesign of di garden, wey take 1,000 hours to finish.
Di garden go dey open to di public to visit for free as from di day afta di unveiling.
Who attend?
Harry, wey dey live for US with im wife, di Duchess of Sussex, and dia two pikin, land for UK last week in order to do di compulsory quarantine before Thursday event.
Kensington Palace bin confam say, in addition to di royal brothers, members of Diana close family go dey di unveiling.
Also, di committee wey handle di statue project – including di man wey do di sculpture – go also attend di ceremony.
Who do di statue?
Ian Rank-Broadley na im do di statue.
Di ogbonge artist dey famous for im design of di Queen wey dey ontop all UK and Commonwealth coin money since 1998.
Earlier dis month, im drawing of di Duke of Edinburgh na im dem use for di limited-edition £5 coin wey celebrate di life of Prince Philip.