Anambra state goment committee of inquiry report say ‘Mmesoma manipulate her JAMB result’

Di committee of Inquiry wey Anambra state goment set up to look into di controversy around allegation say one 19-year-old student wey sit for di last Unified Tertiary Matriculation Examination, UTME bin forge her result to conclude dia investigate and release dia report.

Dem say dia investigate reveal say di candidate manipulate her result.

Di Joint Admissions and Matriculation Board, JAMB, in charge of di exam bin don insist say di candidate – Ejikeme Joy Mmesoma bin score 249 as against di 362 she bin say she score.

According to di report of di committee, Mmesoma from di Anglican Girls Secondary School bin protest go di state goment say she score 362 and dem suppose recognise her afta anoda candidate – Nkechiyere Umeh wey score 360 bin dey recognised as di candidate wit di highest score.

Di committee for dia report say dem chook eye into wetin really happun as dem hear from JAMB how di mata go for dia side. Dem also say dem note several red flags wey JAMB officials highlight like di issue of different date of birth, different registration number, different notification of results template and di different centre name wey dey Mmesoma “manipulated result”.

“For Ejikeme Joy Mmesoma submission, she own up in di presence of her principal, and di Education Secretary say di narration by di JAMB officials na di true and correct description of wetin happun.

She also admit say she give di manipulated result by herself wit di same Airtel number according to her and she come proceed to di cybercafe wia she print di result she manipulate.” Di committee report tok.

Di report also say di Principal of di Anglican Girls Secondary School, Uruagu, Nnewi and di Education Secretary – Diocese of Nnewi Anglican Church express dia shock at wetin transpire for dia presence wia Mmesoma admit say she “manipulate her UTME results, deceive di school, her immediate family and di state goment.”

Di committee for dia recommendation say make di candidate tender unreserved written apology to JAMB, di school and Anambra state goment. Dem say make she do am immediately.

Dem also recommend say make Mmesoma undergo psychological counselling and therapy.

Innoson Vehicle withdraw scholarship award

Meanwhile, Innoson Vehicles say dem don withdraw di scholarship wey dem bin award Mmesoma afta di report of di inquiry come out.

“Di findings from di rigorous investigation now don confam say Miss Joy Mmesoma Ejikeme manipulate her UTME results. Dis conclusion dey deeply disappointing and stand in direct contravention of di values we hold dear for Innoson Vehicles, particularly those wey underscore our scholarship program.

In line wit dis principles and in response to di confirmed findings, we don make di difficult decision to withdraw the scholarship awarded to Miss Joy Mmesoma Ejikeme.” Na so di Head of Corporate Communications and Affairs for Innoson Group Cornel Osigwe write.

Di case wey generate interest across di kontri bin don spark a lot of reaction.

Several calls bin don come out for independent and external investigation of di mata.

Former Minister of Education, Oby Ezekwesili bin call for an independent investigation into di mata.

Di House of Representatives too bin ask JAMB to stay action until di green chamber conclude dia own investigation afta dem set up one adhoc committee to investigate di mata.