Akpabio list: James Manager, Peter Nwaboachi, Samuel Anyanwu reply Godswill Akpabio NDDC contract accuse

Nigeria big politicians wey di Minister for Niger Delta, Godswill Akpabio accuse say dem chop contract from the Niger Delta Development Commission (NDDC) don respond say di minister no get proof for im accuse.

Peter Nwaboachi, on Monday, wey be Chairman of the Senate committee on Niger Delta, say “truth” no dey anytin wey di minister call.

Di lawmaker challenge Akpabio make im send di list of di project wey im collect to anti-graft agency make dem torch light if im get proof for wetin im tok.

Akpabio tok say Nwaboachi collect 53 projects from NDDC.

According to statement wey Nwaboachi release, im tok say make di minister fes account for “reckless payment wet dey in dia billions wey IMC members pay demselves with approval from Mr. Akpabio”.

‘I only attract contract to my domot’

One former lawmaker wey im name dey di list, Samuel Anyanwu, tell BBC pidgin say na only im constituency in attract di projects to,

“Di allegation or whatever Akpabio tok no dey correct. I attracted projects to Imo East and Imo state bin part of NDDC. So, I attract projects to my constituency as ppo representative wey I be. I no collect any contract as a person”.

According to local tori pipo, Akpabio tok say Anyanwu collect 19 contracts.

Also, James Manager, lawmaker way Akpabio tok say collect 6 contract to say im no collect any contract from NDDC.

“NDDC never award any contract to any company wey I get. I nor know any company wey I own wey don do bidding for goment domot anywhere for dis world. E fit surprise pipo but na truth I talk,” na wetin Manager tok for statement wey im send give BBC Pidgin.

All dis gbas gbos dey happun afta Speaker of the House, Femi Gbajabiamila, tok say im go sue Akpabio if im no name lawmakers wey collect contract from NDDC domot.

E dey against Nigeria law make anybody wey dey hold public office bid and to collect contract from goment.

NDDC don dey hot since last year wen di Nigeria President Muhammadu Buhari order forensic audit of di commission account since wey dem establish am.

President Buhari tok say money wey don fo di commission don pass projects wey di commission don do.

Last week, lawmakers for Nigeria tok say make di Interim Management Committee (IMC) to return all “unjustifiable funds” wey dem pay staff of di commission.

Managing Director of di NDDC, Kemebradikumo Pondei, tell di lawmaker say dem spend N1.5 billion for staff as ‘COVID-19 relief funds’.

Pondei later faint for live television as lawmaker dey query am ontop magomago for di commission.