Sierra Leone election 2023: Samura Kamara and Julius Maada Bio wan lead di kontri for five year term

One voter raise im finger

BBC

Sierra Leoneans dey wait for results of dia general election afta campaign wey tension and violence full inside.

Pipo come out well-well to vote, wit voters telling di BBC say di process dey smooth despite say dem no quick start di election for many areas.

Concern bin dey about potential clashes ahead of di election.

High voter turnout dey recorded in many areas for Sierra Leone across 16 districts.

Di expectation be say more dan three million pipo go participate and decide who become dia next President, members of parliament and local representatives.

However, di Presidential Candidate of di main opposition party describe di process as challenging.

Dis go be di fifth election since di end of di kontri brutal civil war, wey end 21 years ago.

On Wednesday, di main opposition party bin allege say police shoot and kill one of im supporter, di accuse wey police don deny.

Supporters of both main parties don chop accuse of attacking opponents.

Dis election dey take place against di background of troubled economy, rising cost of living, as well as concerns about national unity.

Sierra Leone election 2023

BBC
Sierra Leone election 2023
Sierra Leone election 2023

BBC
Sierra Leone election 2023

BBC
Sierra Leone election 2023

BBC
Sierra Leone election 2023

BBC
Sierra Leone election 2023

BBC
Sierra Leone election 2023

BBC

Bio and Kamara vote

Afta im cast im ballot on Saturday afternoon for Lumley Freetown, Samura Kamara tell tori pipo say di election process bin no easy at all for voters due to delay of voting for many polling stations.

Im also allege ballot stuffing and claim say dem no allow im Party agents, candidates and supporters vote in Pujehun and Moyamba Districts.

Even wit all dis tins wey happun im say im dey confident say im go win.

Meanwhile, President Julius Maada Bio cast im ballot for Hockey Pitch Wilberforce in Freetown.

For one online post im ask all eligible voters to carry we no go gree waka go out to express dia sef wit dia voice in a peaceful manner.

Voting start early for some polling stations wia voters express satisfaction on how dem conduct di election so far.

Solomon Beckley wey dey live for Freetown describe di voting process as smooth and di polling unit dey accessible to elderly pipo.

Im say im hope to see day Sierra Leone beta pass as e be now and a responsible goment wey go provide jobs, improve health care and also ensure food security.

Who be di main candidates?

President Maada Bio dey seek re-election for anoda five year term.

E dey enta same trouser wit twelve oda candidates, but experts believe say im major challenger na Samura Kamara, di runner-up for di last presidential election for 2018.

Wetin be di issues for di election

Di economy na one of di main issues for Sierra Leone June 24 elections.

High cost of living challenges and high tax from di govment on business na di problem. Prices of basic commodities according to di Trading Economics report rise to 52.33% in April of 2023, na di highest di kontri don ever experience.

Businesses dey struggle wit high rate of di dollar daily.

Di opposition don blame President Maada Bio govment for di lack of effort to control di hike of di dollar in di market wey dey affect many business.

Despite di re-domination of di kontri currency wey happen for 2022, e no create any impact on di economy as di old currency still be legal tender and inflation continue to dey rise. and Samara vote

Afta im cast im ballot on Saturday afternoon for Lumley Freetown, Samura Kamara tell tori pipo say di election process bin no easy at all for voters due to delay of voting for many polling stations.

Im also allege ballot stuffing and claim say dem no allow im Party agents, candidates and supporters vote in Pujehun and Moyamba Districts.

Even wit all dis tins wey happun im say im dey confident say im go win.

Meanwhile, President Julius Maada Bio cast im ballot for Hockey Pitch Wilberforce in Freetown.

For one online post im ask all eligible voters to carry we no go gree waka go out to express diasefs wit dia voice in a peaceful manner.

Voting start early for some polling stations wia voters express satisfaction on how dem conduct di election so far.

Solomon Beckley wey dey live for Freetown describe di voting process as smooth and di polling unit dey accessible to elderly pipo.

Im say im hope to see day Sierra Leone beta pass as e be now and a responsible goment wey go provide jobs, improve health care and also ensure food security.

How winner go emerge?

Di winner gatz get 55% of di valid votes cast, if dat one no happen, a run-off between di top two candidates from di first round go happun.

Belief dey say young voters fit be di ones to decide di outcome of dis election.