How South Africa next president go emerge afta ANC shock loss

President Cyril Ramaphosa

Reuters

South Africans use dia thumb send message give dia leaders say tins no dey go on well.

For di election wey see di lowest turnout in dia history, di governing African National Congress (ANC) suffer dia worst result since apartheid end 30 years ago.

Cyril Ramaphosa im ANC win 159 seats for 400 – seat parliament – dem get 230 seats from di previous assembly.

President Cyril Ramaphosa tok say dis na “challenging result despite say na victory for democracy”.

Im call di rival parties to find common ground wey dey point to say im dey prepare for coalition talks.

Since 1994, di ANC win majority of seats for parliament – 252 seats in 1994, 266 seats in 1999, 279 seats in 2004, 264 seats for 2009, 249 seats in 2014 and den 230 seats in 2019.

Wit di 159 seats wia dem get for di May election, ANC don drop significantly.

South Africa election result 2024

BBC

Dia share of votes also drop below 50% for di first time.

Since Nelson Mandela don become president for dia first democratic elections for 1994, di ANC always dey get ova 50% – in 1994 dem get 63%, 66% in 1999 and 70% in 2004.

Di ANC also get 66% in 2009, 62% in 2014 and 58% in 2019.

Support for di party don dey drop sake of pipo vex ova corruption, unemployment, crime as well as di high cost of living for di kontri.

Dem also vex about di frequent power cuts.

Wit dis result, Cyril Ramaphosa gatz to begin to dey tink about say im go form coalition goment.

Cyril Ramaphosa gatz to form coalition goment

Since di party no manage to pass di 50% mark for di votes last week, di ANC gatz to gree on a coalition wit anoda party or parties for di first time to co-govern di kontri and re-elect Ramaphosa for second term.

Di national elections for South Africa dey decide how many seats each party go get for parliament wey lawmakers go elect di president later.

Out of di parties wey take part for di elections, na eight of dem wey get beta vote, even though some of dem including di MK party wey former president Jacob Zuma don dey lead, don lodge complaints say voting irregularities happun during di process.

Di Democratic Alliance (DA) win di second most votes wit 21.8%, dis dey mean say dem and di ANC fit to hold majority together wey dem fit to govern.

Di DA increase dia number of seats for parliament from 84 for 2019 to 87 for dis election.

Leader of di party John Steenhuisen tok say im party don also begin toks wit parties ova possible coalition.

“We dey urge everibodi wey love our constitution to set aside petty politics and interests, to join hands now”.

South Africa election result 2024

BBC

But Steenhuisen im party no dey gree wit di ANC black empowerment and national health insurance bill wey dey promise universal healthcare for all.

Di ANC however tok say dis two policies na non-negotiable for di coalition toks.

Di oda options na Jacob Zuma imparty uMkhonto weSizwe (MK) party wey get 15% of di votes.

Anoda party na di radical economic freedom fighters (EFF) – DEM GET 9%, so coalition betweebrt dis two (DA and MK) go fall short of di 50% wey di constitution tok say im dey required to form coalition.

Di pressure don dey mount as di new parliament gatz to sit for di first time and elect a president within 14 days afta dem don declare di election results.

South Africa election result 2024

BBC

Wetin be coalition goment, how dis go determine SA next president

Coalition goment according to South Africa constitution na di situation wen two or more political parties or independent representatives, combine dia votes for legislature or council, to elect a goment and support di decisions dat goment go take.

Dis dey happun if no single party get majority of di seats for di legislature.

For South Africa, elections always dey lead to plenty parties wit representatives for parliament, wey di executive leadership bin dey always elected by dat legislature.

Dat same legislature also fit to remove di president, but if none of di parties get more dan 50% of di seats, di coalition now dey necessary to support di executive, odawise di president fit to be voted out of power.

Dis no go be di first time coalition go happun for di kontri. Coalition don dey since 1994.

South Africa election result 2024

BBC

Di first democratic national goment afta di 1994 election na broad-based coalition – a goment of national unity.

Coalitions also don dey for di provincial level for Western Cape and KwaZulu-Natal, wey coalitions also don dey for municipalities since di first democratic local goment elections for 2000.

Coalition goment fit to deepen democracy wey im dey allow multiple parties to represent different ideologie and cultures.

Im also dey allow compromise-based policies wey fit to last longer even afta di majority party don lose power.

South Africa election result 2024

BBC

But at di same time, coalition goment fit cause big wahala.

For dis scenario, di composition of di goment no dey reflect di will of di pipo well well.

Coalition goments fit to be unstable sometimes, especially if di partnership dey weak and fight don happun, di coalition go scatter.

If dis happun, decision go dey drag wey di legislature go dey engage for politics instead say dem go focus on governance and service delivery for di pipo.

Source