Singer Cassie accuse rap superstar Puff Daddy of rape and abuse

Cassie Ventura and Puff Daddy

Getty Images

Rap artist Sean “Diddy” Combs don chop accuse of rape and sex trafficking by one female singer.

For one court case wey BBC see, im ex-girlfriend Casandra Ventura say she bin dey trapped inside 10 years of abuse and violence.

Combs – wey im name for stage na Puff Daddy – don deny di allegations, plus accuse di singer say she wan squeeze money comot from im body.

Im lawyers say di claim dey “offensive and no make sense”.

Ventura – wey be R&B singer and dancer wey dey perform wit di stage name Cassie – allege say di rap producer rape and beat her for more dan 10 years starting from wen she bin dey 19 and e bin dey 37.

“After years in silence and darkness, I finally ready to tell my tori,” she tok for one statement on Thursday.

Di case include plenty graphic descriptions of di violent abuse wey she say bin occur wen she first meet di rapper for 2005.

Cassie Ventura and Puff Daddy

Getty Images

According to di complain, Combs sign her for im record label, Bad Boy, and “harass di vulnerable Ventura wit drugs and alcohol, causing her to fall into dangerous addictions wey bin control her life”.

Di case label di musician as “serial domestic abuser, wey bin dey always beat and kick Ventura, leaving her wit black eyes, bruises, and blood”.

For her statement, Ventura say she ready “to speak up on behalf of myself and for di benefit of oda women wey face violence and abuse for dia relationships”.

For one statement to BBC News, Combs lawyer say Ventura demand $30m (£24m) “inside di threat say she go write book about dia relationship wey go cause damage”.

Im lawyer, Benjamin Brafman, say dem “unequivocally reject” di alleged demand “as blatant blackmail”.

“Ventura now decide to carry di mata go court, na baseless and shocking lies full am, wey dey target to spoil Combs reputation, and cash out,” im add.

For response to Brafman, Ventura lawyer, Doug Wigdor, say Combs bin wan pay her “eight figures to keep her quiet and prevent di court case”.

“She reject im efforts and decide to give voice to all woman wey dey suffer in silence,” im say.

Her court case also allege say di music superstar tell her im plan to “blow up” one car wey belong to rapper Kid Cudi.

Combs bin dey jealous say Ventura bin dey relationship wit di rapper, according to di legal action.

She say im tell her of im plan during Paris Fashion Week for 2012.

“Combs tell Ventura say im go blow up Kid Cudi car,” di complainant tok, “and say im bin want to make sure say Kid Cudi go dey house wit im friends wen e go happun. Around dat time, Kid Cudi car go explode for driveway.”

One tok-tok pesin for Kid Cudi tell New York Times say wetin Ventura tok na true.

She release several hits for 2000s, including songs wey she bin collabo wit Diddy.

Her most famous tracks include Me & U, Long Way to Go and Official Girl, wey she collabo wit Lil Wayne.

Source