Why Premier League deduct ogbonge 10 points from Everton

Everton logo

Getty Images

Everton don chop immediate 10-point deduction afta dem find say dem breach di English Premier League profit and sustainability rules.

Dis na di biggest punishment wey don happun for sporting sanction since di history of di Premier League.

Dis deduction go leave Everton for di 19th position for di Premier League table.

Di club say dem dey “both shocked and disappointed” by dis kain “wholly disproportionate and unjust” ruling.

Everton say dem intend to appeal against di decision.

Di Premier League bin refer Everton go independent commission wey dem setup but dem no reveal di kain alleged breach wey dem sama di club.

Wetin happun?

Dis whole mata don start since March and di offence na since di 2021/2022 season.

Everton bin post financial losses for di fifth successive year for March afta dem report £44.7m deficit for 2021/2022 season.

According to Premier League, clubs dey permitted to lose £105m ova a three-year period and Everton admit say dem breach di profit and sustainability rules (PSR) for di season wey end for 2021/2022.

For October, afta a five-day hearing di commission find say Everton losses during dat period don amount to £124.5m and e favour Premier League.

Everton for dia statement for March 2023 wen di mata bin dey reach serious stage deny di wrongdoings and reveal say dem dey ready to defend dia stand.

“Di club strongly contest di allegation of non-compliance and togeda wit our independent team of experts dey very confident say we remain compliant wit all di financial rules and regulations.

“Di club don provide information to Premier League for several years for open and transparent manner and we dey conscious to act wit utmost good faith at all times,” Everton tok for March 2023

Meanwhile, for March 2022 Everton announce loss of £120.9m for di 2020/2021 season.

E mean say dat kain loss for ova a period of three years go reach up to £372m and dat don pass three times di £105m wey Premier League rules bin permit.

Although di club bin blame Covid-19 as part of wetin cause di losses, but dem hold say di club remain for ” a secure financial position”.

Everton wey don dey di process of building dia new Bramley-Moore Dock stadium go dey affected wit dis new deduction

Source