‘I bin feel like say na fly I kill’ – tori of ex-con, illegal guns and fear of Kenya police

A handgun sitting on someone's knee

BBC

As Kenya dey struggle wit violent crime, BBC Africa Eye follow one former criminal as im dey try convince oda men to surrender dia illegal weapons, one gun at a time.

“Di worst tin wey I ever do na to kill. I kill one man,” di young man tok afta im agree for us to feem am but wit condition say we hide im identity.

“I bin no feel anytin, becos I bin dey high on drugs. I bin feel like na fly I kill.”

Samuel, no be im real name, dey Kisumu near Lake Victoria for west of Kenya, to meet King Kafu, one former convict wey dey now help pipo leave crime.

You fit see say im bin dey fear. E carry AK47 inside one corner wey bin wan hand over to di police.

Ask am why, im say: “one day go come wen my family no get anytin to chop. Dem go dey hurt eventually.

“If I go mess around, and den dem come shoot me, nobody go dey to take care of my family. So I decide, from my mind, make I return dis tin.”

Number from Kenya National Bureau of Statistics show say violent robberies don increase by almost 20% last year.

Dem dey smuggle illegal weapons enta di kontri through borders wey dey leak, and dis na why no kontri for East Africa get di kain number of civilians wey dey carry weapons like Kenya pipo, according to Institute of Security Studies.

Di latest figures from Small Arms Survey, wey dey track global weapons trends, suggest say, dem get reach 750,000 firearms for di hands of civilians for Kenya.

Dat na more dan di total number of weapons wey dey di hand of army and police if you combine dem.

Kafu dey act as middleman between pipo wey wan hand over dia guns and police.

Man dey tok for microphone

BBC
King Kafu uses his radio programme to appeal to young people to turn away from crime

Im bin dey 15 years wen im first enta crime. E bin start wit snatching pipo fone, later im elevate to armed robbery.

For 2003, dem send am go chill for prison for four years.

Samuel bin contact am for Instagram asking for help.

Kafu tok to di local police for Kisumu and dem agree to accept Samuel gun, wit promise say dem no go investigate am as par one well-established amnesty programme.

But wen di time reach to meet wit di AK47, Samuel no show.

Kafu, now 40, na presenter for Ghetto Radio, one station wey popular among young pipo for di ghetto area of di capital, Nairobi, and im dey use im platform to tok against gun violence.

“Afta my release, I discover say many of my friends wey bin dey do crime don die, most of dem die as result of dia criminal lifestyles,” im say.

Na dis one make am turn im life around.

“Dem no born anybody as tiff. But even if youths no get work, we dey tell dem di truth say crime no good. Pipo suppose return dia illegal guns to di goment,” im tok.

Inside di last 20 years Kenya goment don use amnesty as way to control gun crime, by promising immunity to pipo wey surrender dia weapons.

Thousands of guns don return to goment hand. But dis na tiny number of di illegal weapons wey dey circulate.

Man silhouetted by a window

BBC
Pipo wey wan hand dia guns dey nervous make dem no identify dem

One criminal tell BBC Africa Eye say to buy gun for Kenya easy. Im say im fit buy one for 40,000 Kenyan shillings ($300).

Kafu say pipo wey dey willing to hand over dia illegal firearms to di authorities dey fear say dem sef fit become target.

Police dey face accuse say dem get hand for extra-judicial killings.

Kenyan NGO Missing Voices say more dan 800 pipo don die for di hands of officers inside di last five years.

Majority of dem na poor young men.

For Nairobi, BBC Africa Eye follow Kafu to meet anoda man, wey we go call John, wey dey willing to give up im gun.

“I ready to return am. You go kill pesin. You go spend di money wey you get for am within three months, but you don shed pesin blood. You don make pesin sad and you dey wit di guilt. Dat life na trouble.”

John biggest fear of going to the police was that something would happen to him.

Im describe wetin happun to him friend wey bin confide in one elder for di community say im wan surrender two guns. Police pick am up and di next tin na for mortuary dem find am one week later.

“Di problem na trusting who to tell, how to hand am in,” im say.

E get one popular allegation say Kenyan police dey hire and sell firearms and ammunition to criminals.

BBC Africa Eye ask police abut dis claim but dem no respond.

Man speaking to journalists

BBC
King Kafu na middleman between police and pipo wey dey hold illegal guns

Kafu call di local police chief to reassure di man about im safety and a few days later dem go police station togeda wit di gun.

Di officer check di serial number wey dey di weapon and e bin get KP mark wey be short form for Kenyan Police.

For one police press conference wia dem announce di return of di weapon, Kafu make public statement to make sure say police repeat dia commitment to keeping dis men safe.

“I want make goment dey clear wit di youth. Wen dem return dis tins, dem go support dem? I dey ask goment to cooperate. Dis youths wan show some love.”

Dis alone no go stop violent gun crime for Kenya, but Kafu say dis na di beginning.

Criminals trust am, im say, and hope say im go fit encourage more pipo to surrender dia weapons without fear of revenge.

“We dey try fight for dis youths,” Kafu say.

Source