Real Madrid win UEFA Champions League trophy

Vinicius score for Real Madrid.

Getty Images

Real Madrid don win di UEFA Champions League trophy as dem beat Dortmund for Wembley stadium.

Afta an incredible 90minutes play by both team, di Madrid team prove say dem sabi football for pitch wit two goals within 9minutes.

Incredible scenes as Vinícius Jr throw imself to wia Real Madrid fans dey.

Toni Kroos dey wave at di crowd and Carlo Ancelotti dey hug someone else for di crowd.

Dis game dey hot till di 74mins wen Dani Carvajal bin surprise Dortmund wit an header wey put dem for early lead.

Na Toni Kroos do di assist wey give Real Madrid early lead against Dortmund.

For di 83mins, Vinicius Junior put an incredible strike for di back of Dortmund net– to put di scoreline at 2 goals.

Dortmund try to equalise but dia only goal dey disqualified sake of offside position.

Na so dia hope dey dashed.

Now, Real Madrid do win di European Cup/Champions League trophy more dan twice as many times as any oda team.

Borussia Dortmund players no happy as dem dey go receive dia runners-up medals. Dia fans even wait till di end of di game though dem lose.

Carlo Ancelotti don win di Champions League as a manager five times.

Such an incredible trailblazer for any club wey im go.

Fireworks all ova Wembley stadium as Real Madrid captain Nacho go receive di Champions League trophy.

Real Madrid is now di European king and Champions League winner.

Live updates: How di match go

Borussia Dortmund 0 vs 2 Real Madrid

FINAL WHISTLE

90mins+5- Incredible play by real Madrid.

5mins Added Time

90mins- Vinicius come off for Real Madrid.

87mins- Meanwhile, Toni Kross kollect a standing ovation from di Real Madrid fans wen im come off.

Im career go end wit a sixth Champions League winners medal.

85mins- Jude Bellingham don come off for Real Madrid and Jamie Bynoe-Gittens enta for Borussia Dortmund.

Goal Cancelled for Dortmund

83mins- Dortmund get di ball for di back of di Real Madrid net.

OFFSIDE GOAL

Borussia Dortmund 0 vs 2 Real Madrid

Vinicius Junior score for Real Madrid

82mins- Goooaaallll

79mins- Toni Kroos take free kick for Real Madrid.

Borussia Dortmund 0 vs 1 Real Madrid

Carvajal score for Real Madrid

Getty Images

Carvajal score for Rel Madrid

GOAAAAAAAAAAAAAAAAAALLLLLL

71mins- Great play by Vivicius for dia but e chop confam marking.

Adeyemi out, Reus enta for Dortmund. E go fit create any chance for goal?

SUBSTITUTION

68mins- Oh, a miss by Bellingham. E remain small make im head nod ball inside net for Real Madrid to lead but e go wide ova im head.

67mins- Incredible run by Vinicius but not enough energy.

66mins- Thibaut Courtois don make three decent saves for dis final.

64mins- Corner for Real Madrid side.

62mins- Oh What a STRIKE- Real Madrid goalkeeper push am comot.

61mins- Good run by Rodrygo into di middle. But Dortmund player stop am.

Jude Bellingham neva dey for im best play dis night and Real Madrid dey expect confam play from am

59mins- Big chance for Dani Carvajal wey dey free inside di Borussia Dortmund penalty area but im fire straight to Gregor Kobel.

58mins- 35 touches by Jude Bellingham so far and no attempts- e gatz change di game wey im dey play for goals to come.

57mins- Great attack from Dortmund and goal save from dia keeper too.

55mins- Oh Adeyemi give Carvajal a strong tackle.

53mins- Rodrygo dey try create some chances for real Madrid but e no reach

E get plenti empty seats for di VIP areas for Wembley. Be liek say dem still dey enjoy dia half-time refreshments.

52mins- Carlos Ancellotti go dey hope for a win tonight.

One smoke dey comot and spread across di Wembley stadium sake of wetin Dortmund fans dey spray.

51mins- Corner again.

Borussia Dortmund 0 vs 0 Real Madrid

50mins- None of di teams don make any changes yet– no substituion

48mins- Corner Kick for Real Madrid . Oh no, ova di bar.

Real Madrid don wake from dia sleep wit strong attack.

47mins- Free Kick for Real Madrid. E go be a good chance for dem. Kroos play confam free kick but e go corner.

46mins- Real Madrid dey prove strong for dis second half.

Borussia Dortmund 0 vs 0 Real Madrid

SECOND HALF Begin

Jude Bellingham and Jadon Sancho

Getty Images

Borussia Dortmund 0 vs 0 Real Madrid

HALF-TIME

45+4mins- Di keeper dey block am and players dey clear am go corner again

Corner Kick for Dortmund

45+2mins- Dortmund giving serious tackle to Real Madrid.

4mins ADDED TIME

44mins- Vinicius dey complain but di referee no send am.

43mins- Sabitzer chop yellow card for Dortmund side. Be like say im no care shaaa.

YELLOW CARD

42mins- Dortmund dey get confam chances

Vinicius dey try get di ball

Getty Images

Borussia Dortmund 0 vs 0 Real Madrid

40mins- What SAVE by Real Madrid Goal keeper

39mins- Nico chop red card afta im tackle Vinivius.

YELLOW CARD

38mins- We don dey approach di 40 minute mark. Dortmund no go want make dis first half end like dis.

35mins- Real Madrid player Vinicius Junior don chop yellow card sake of foul against Dortmund goalkeeper.

Gregor Kobel gatz fly afta Vinicius attack am wit serious run.

YELLOW CARD

32mins- Oh, what a tackle against Mendy. But im don stand to resume play.

30mins- And here come Borussia Dortmund again as dem dey run go real Madrid goal post.

28mins- Great goalkeeping from Thibaut Courtois so far, if no be so, Real Madrid for don chop up to 3-0 by now.

26mins- Dortmund move closer to Real Madrid post again. Oh noooooo, di keeper catch am.

24mins- Half a chance for Jude Bellingham, im no fit hold di cross wey dem give am well.

Borussia Dortmund 0 vs 0 Real Madrid

Dortmund miss dis goal

Getty Images

22mins- Serious threat for real Madrid post. Oh No, di ball hit di post. Dat one suppose be goal oooo.

Dortmund dey ALL OVER Real Madrid post oooo!

What a chance for Niclas Fullkrug who put di ball behind di keeper but di ball bounce for di post and hit it back.

Agonising for Dortmund. Another let-off for Real.

Corner for Dortmund. Di keeper catch am from up.

20mins- Ohhhhhhhh!! What a miss. Adeyemi one-on-one wit di goalkeeper of Real Madrid. But e miss am.

18mins- Good start by Dortmund as dem dey lively an eager to score.

Meanwhile, Gregor Kobel hneva get any confam save since.

16mins- Ohhhhh!!! What a wide shot. Federico Valverde shoot wide and almost clear di Wembley roof, while Jadon Sancho take bin fall bu game goes on. Now a chance for Julian Brandt but im put am wide from inside ddi box.

12mins- Dis na di last game for Toni Kroos wey don get correct club career. See as he throw out confam pass.

Borussia Dortmund 0 vs 0 Real Madrid

10mins- Di atmosphere dey very exciting. Unfortunately goal neva enta for di fans to cheer loud. Di two goalkeepers Gregor Kobel and Thibaut Courtois neva make any serious save yet.

8mins-

6mins- Good defending by Antonio Rudiger wit a solid headed clearance afta Dortmund break at pace. Di German fans inside Wembley like dt kain attack.

4mins- Emre Can dey captain Dortmund. Im be substitute wen Liverpool lost to Real Madrid for di 2018 final.

2mins- Whistles and jeers all around Wembley due to aone pesin wey come invade di pitch. Dem stop di game to carry di pesin comot

1mins- Na night wia legends dey born and Dortmund get di 2024 Champions League final under way.

MATCH don Start

0 mins- Di two captains don exchange di opening shakes. And Wembley dey filled up to watch dis game.

Borussia Dortmund 0 vs 0 Real Madrid

Real Madrid team news – Courtois start as Lunin on bench

Real Madrid name dia side for di final more dan two and a half hours before kick-off for Wembley.

Thibaut Courtois go start in goal as expected – dis go be im first Champions League game in more dan 12 months – but Andriy Lunin dey well enough to make di bench afta e dey down wit sickness.

Toni Kroos dey set for im final club game before im retirement later dis summer, while Jude Bellingham go play for im now familiar number 10 role.

Line ups

Dortmund XI: Kobel, Schlotterbeck, Sancho, Fullkrug, Hummels, Brandt, Sabitzer, Maatsen, Can, Ryerson, Adeyemi.

Subs: Meyer, Lotka, Ozcan, Nmecha, Haller, Reus, Wolf, Moukoko, Malen, Sule, Watjen, Bynoe-Gittens.

Real Madrid XI: Courtois, Carvajal, Rudiger, Nacho, Mendy, Valverde, Camavinga, Kroos, Bellingham, Rodrygo, Vinicius Jr.

Subs: Lunin, Kepa, Militao, Alaba, Modrid, Joselu, Vazquez, Tchouameni, Ceballos, Garcia, Ibahim, Guler.

Source