Controversial Ghanaian YouTuber finally get bar call afta dem deny am twice

Di General Legal Council for Ghana don finally call popular social media influencer and YouTuber, Ama Governor to di bar.

Dis na afta dem deny am two times despite say im pass all di courses for law school.

Di openly bisexual Ama Governor spend six years for im legal education wey im for complete for November 2022.

But di legal council yank am off sake of wetin dem describe say na “misconduct”, afta one Hajia Siduri file petition against am.

Di petitioner tok say di way Ama don dey dress and im social media activities dey “inappropriate”.

According to di petitioner, Ama bin dey wear skimpy clothes wey im dey do too much for social media.

Na so dem no call am to di bar for November 2022.

At di time, Ama tok say di legal council don treat am “unfairly”.

Chief Justice Gertrude Torkonoo tok for August 2023 say Ama deserve im fate.

Di CJ explain say “if you wan come di legal sector, your conduct for no be obscene den offensive.”

Im also add say law students gatz to watch dia social media comments.

Ama respond say im neva know wetin im do wrong to deserve di way di legal council dey treat am.

Ama tok for October 2023 say di legal council dey “victimise am sake of im be bold pesin wey dey advocate body positivity, sexual liberation den self-worth.”

Im also add say “di fact say I be queer no be justification say make dem deny me call to di bar.”

Legal council bin bounce Ama Governor

For September 2023, afta plenti tok tok for social media, di legal council explain say dem dey consider to allow make Ama join di October session.

But many pipo sabi say viral video for one anti-goment protest wia Ama tok say im win di case against di legal council afta dem summon am ova di mata, make di legal council change dia mind.

Inside dat video, Ama tok say petitioner give “two fallacious grounds and one insufficient ground wia di committee throw out.”

“I tok di committee say I be queer, pansexual but dat no mean say I no fit to be lawyer,” Ama explain.

But two days bifor di call to di bar, di legal council don write to Ama say dem revoke im call for di second time.

For one letter wia di judicial secretary Pamela Koranteng don sign, di council tok say “we dey decline your call sake or some tins we see for your public conduct prior to your application to di council.”

Di council add say dem go continue to dey monitor im conduct for now.

Ama Governor finally get call to di bar

Afta two years of social media wahala and warning from di chief justice, dem don finally call Ama to di bar.

For di mini call wey happun for di Accra international conference center, Ama wey im real name na Elorm Ababio receive im certificate.

Ama dey among di 150 new lawyers wey dem enroll into di general legal council list.

Inside one video di bubbly YouTuber bin dey smile as im waka to di stage to receive im certificate.

One pesin ask am how im dey feel about say im finally get di call after two years, Ama explain say “I no fit to tok at dis time, my lips don seal”.

Source