Labour declare nationwide strike sake of minimum wage

Nigeria Labour Congress

BBC

Di Nigeria Labour Congress (NLC) and Trade Union Congress (TUC) don declare indefinite nationwide strike from Monday, 3 June.

Di strike dey come afta di labour join bodi no fit secure new minimum wage from di federal goment.

Labour bin announce di strike for one joint TUC/ NLC news conference for Abuja on Friday, 31 May.

Di ogas of di labour unions bin try reach agreement for new minimum wage wit federal goment bifor di end of May, but e no work out.

Federal goment bin no gree raise di moni from N60,000 minimum wage wey dem tok for dia last meeting.

Dem dey insist on N497,000 as minimum wage.

“We reiterate say since di National Minimum Wage negotiation exercise neva dey concluded and di agreed wage neva dey passed into law; di hike in electricity tariff neva dey reversed and di categorisation of consumers into bands neva stop as demanded; Nigerian workers dey compelled by dis failures to embark on one indefinite nationwide industrial action wey go begin on Monday, di 3rd of June, 2024 to press home our demands,” president of TUC Festus Osifo tok.

Initially, di Nigerian goment bin dey propose to add N18,000 to di current N30,000 national minimum wage, making it N48,000 for di new minimum wage, according to di leadership of di organised labour.

But dis na far cry from di N615,000 wey di labour unions for Nigeria bin don present to goment as wetin dem believe suppose be di new minimum wage, a proposal di goment also describe as unrealistic.

Di national president of di Trade Union Congress, Festus Usifo, tok say N48,000 dey even lower dan wetin di least earning federal worker dey currently earn.

Remember say President Bola Tinubu bin announce a N35,000 wage award to federal workers from October 2023 until new minimum wage go start. E mean say di least personnel for di Nigeria civil service dey currently earn at least N65,000 monthly.

“Di goment proposal of a small N48,000 as di minimum wage na insult to di sensibilities of Nigerian workers and e also fall short of meeting our needs and aspirations,” di NLC and TUC bin tok for a joint statement on Wednesday 15 May 2024.

Goment authorities neva make any comment yet about dis recent development.

“As at wen we bin negotiate N18,000 for 2011, di money fit buy two bags of rice. Wen we bin negotiate di N30,000 for 2019, e fit buy at least one and half bags of rice. Today, N48,000 no go fit buy one bag of rice, so how pesin fit survive on dat amount?” Usifo tok for TV interview on dat Wednesday.

Source