Final results from South Africa show ANC party lose parliamentary majority

One South African dey happy as she hold one party flag

AFP

Di African National Congress (ANC) no clear majority of di seats for di South Africa National Assembly for di 2024 general elections.

Di ruling ANC party get only 159 out of 400 seats for di National Assembly, di kontri electoral commission announce.

Na di ANC bin dey clear majority of di seats since 1994 but dem fail dis time.

South Africa President Cyril Ramaphosa tok say di result of di election na victory for democracy – even as im party lose di majority.

Breakdown of di results

Chairman of di electoral commission for South Africa Mosotho Moepya don announce how di seats go dey distributed for di 400-member National Assembly.

Here na di top parties:

ANC – 159 seats

DA- 87 seats

MK – 58 -seats

EFF – 39 seats

IFP – 17 seats

PA – 9 seats

Di remainder of di seats bin go to smaller parties.

Dis confam say ANC go need to do coalition to form di next government.

Oga Moepya, afta di announcement tok say di 2024 elections dey “free and fair”.

“Let us celebrate dis achievement as we remain vigilant – for di work of strengthening democracy na one wey no dey ever end.”

Our pipo don tok weda we like am or not – Ramaphosa

President Cyril Ramaphosa don accept di will of di South African pipo afta e suffer big blow for di election.

“Our pipo don tok weda we like am or not,” he says.

“Through dia votes dem don demonstrate clearly and plainly say our democracy dey strong and e dey endure.”

E add say afta 30 years, South Africans suppose dey grateful say dia democracy dey work.

“We must respect dia choices plus dia wishes.”

E also add say dis na time to put South Africa first.

How South Africa dey chose dia president

Now wey di kontri electoral commission don declare final results from di general election, di new parliament go meet within two weeks.

Normally, dat na also wen di new members of parliaments go elect di new president, but some legal experts say e fit dey delayed for one month.

If dem no reach any agreement by then, dem gatz organize fresh general election..

So gone are di days wen di ANC dey use dia parliamentary majority elect di president.

As na only 40% of di new MPs go dey from di ANCdem go need di votes of MPs from oda parties as na majority of MPs go elect di president.

Senior ANC official Fikile Mbalula don tok say Oga Ramaphosa go remain as dia candidate, and di party no go agree to coalition wit any party wey go demand im resignation.

How dem dey form coalition for South Africa?

Di constitution no spell out how dem fit form coalition if no party get more dan 50% of di vote.

But assuming di ANC remain di largest party, smaller parties fit informally agree to support ANC government on a vote-by-vote basis in return for some concessions.

Or, at di oda end of possibilities, di ANC fit enta formal coalition wit some parties, including a written agreement wey go outline legislative plans and di distribution of cabinet posts.

Any oda party go face di same choices.

How general elections take dey work for South Africa?

Di number of seats dem dey allocate give parties for di 400-member National Assembly dey directly related to dia share of di vote.

For 2024, dem include independent candidates for di first time.

Dis one mean say South Africans bin get three votes:

  • National parliament: One for 200 of di seats wit just political parties wit dia name on di ballot
  • National parliament: One for di remaining 200 seats wit a different ballot paper for each of di nine provinces, wey go list di parties for dat region and independent candidates
  • Provincial assembly: One for di independent candidates or parties for di regional legislature.

Source