Light off, schools close, airports grounded as NLC strike witness ogbonge compliance

NLC Protest from bifor

BBC

Di strike wey di organized labour for Nigeria declare don take effect as dem bin announce am on Friday.

Already some affiliate unions don tell dia members to comply wit di nationwide strike wey start on Monday.

Di Transmission Company of Nigeria say dem don shut down di national grid, wey don make light no dey for many parts of di kontri.

Di National Union of Electricity Employees bin release dia own statement wey dem announce say dem dey join di strike say, “di withdrawal of services go start Sunday 2nd June by 12:00 Midnight,” according ot Dominic Igwebike wey be Ag General Secretary.

Meanwhile, di Nigeria Union of Petroleum and Natural Gas Workers tok say dem sef dey join di strike action. For statement we di Generl Secretary, Comrade Afolabi Olawale sign, dem say na bicos “as union, we dey worried ova id insensitive response of di Federal goment on di mata of negotiating new minimum wage.”

On Sunday, members of di National Assembly bin meet wit di members of di Nigeria Labour Congress (NLC) and di Trade Union Congress (TUC) to see how to quench di strike. But e no work.

Tori be say di meeting wey last for ova four hours no end well as di TUC chairmo comot to tell journalists say di nationwide strike go hold.

“We maintain say since di National Minimum Wage negotiation exercise neva dey concluded and di agreed wage neva dey passed into law; di hike in electricity tariff neva dey reversed and di categorisation of consumers into bands neva stop as demanded; Nigerian workers dey compelled by dis failures to embark on one indefinite nationwide industrial action wey go begin on Monday, di 3rd of June, 2024 to press home our demands”. President of TUC Festus Osifo tok.

Di unions dey demand for 494,000 naira ($370) per month as di new minimum wage sake of di current reality but di Nigeria goment and organised private sector dey offer to pay 60,000 naira ($45).

Currently for Nigeria, 30,000 naira na im be di minimum wage and not all states for di kontri dey pay am.

Passengers wey hook bicos of di strike

BBC
For di domestic wing of di Murtala Mohammed Airport for Lagos, plenti passengers dey stranded
Passengers wey hook bicos of di strike

BBC
Some of di passengers tok say dia flight support don move but sake of di strike, dem no fit go wia dem suppose go
Deserted Federal Secretariat wit some workers hanging outside

BBC
NLC don dey monitor compliance for Abuja as workers just dey waka outside di Federal Secretariat
Outside of Asokoro hospital

BBC
Patients dey look dejected as dem hear say doctors no go see dem
Rivers State Hospital

BBC
Doctors and oda medical staff no join di nationwide strike action for Rivers State University Teaching Hospital say dia union leaders no tell dem to join
Students wey dey outside school

BBC
Some students wey come schools gatz ho back to don houses becos of di strike action but only SS3 students wey dey write WAEC exams dey

Di Minister for Information and National Orientation, Mohammed Idris say di sum of 494,000 naira national minimum wage wey labour unions dey demand no dey sustainable.

Oga Idris wey tok dis one during one press conference for Abuja, di kontri capital explain say di amount wey di union dey ask fit scata di kontri economy.

Meanwhile for statement, police ask di labour groups make dem no run dia planned strike becos e fit create hardship for kontri pipo we fit cause kasala.

Police FPRO, ACP Olumuyiwa Adejobi tok say: “Even though we sabi say organised union get right to to do strike to ginger for di interests of all workers… Becos Federal goment don call di planned strike say e dey illegal and premature, di Nigeria Police Force dey look dis action as potential cause for more tension and political instability.”

Wetin lead to dis kasala?

Di ogas of di labour unions bin try reach agreement for new minimum wage wit federal goment before di end of May, but e no work out.

Labour dey ask for 497,000 naira as minimum wage but federal goment say dem no go pay pass 60,000 naira

At first, di Nigerian goment bin dey propose to add N18,000 to di current N30,000 national minimum wage, making it N48,000 for di new minimum wage, according to di leadership of di organised labour.

Source