Man City Vs Inter Milan Champions League Final highlights: How Rodri goal give City dia first UEFA trophy

Manchester City

Getty Images

Man City achieve dia long goal to win di Champions League afta dem beat Inter Milan for Istanbul as Pep Guardiola side complete di Treble.

Dem become di second only English club to do so afta Rodri 68th minute ogbonge strike end for goal.Man City achieve dia long goal to win do Champions League afta dem beat Inter Milan for Istanbul as Pep Guardiola side complete di Treble.

With dis match, Man City wan try win Treble with di FA Cup and Premier League titles under dia belt already.

Manchester City bin beat Real Madrid 5-1 on aggregate to reach dia second Champions League final in three seasons afta dem lose to Chelsea for 2020-21.

Manchester United na di only oda English side wey don win di Treble – Premier League, FA Cup and Champions League – dem run am for 1998-99.

Inter Milan bin beat AC Milan 3-0 on aggregate to reach di final.

Three time winners Inter Milan last win di Champions League by beating Bayern Munich for 2010.

Inter bin dey aim to be di European Champions for di first time since 2010.

Kevin de Bruyne and Pep Guardiola

Getty Images
Kevin De Bruyne bin comot di game afta e pick up injury

How di game bin happun live

FULL-TIME: Man City 1 -0 Inter Milan

Whistle don blow. City na di champions of Europe!

90+5 mins – Ederson save City for corner.

90+5 mins – Inter keeper Onana don turn midfielder

90+4 mins – Anoda Inter free kick but Ederson catch Andre Onana long free kick under pressure.

90+4 mins – YELLOW CARD

Ederson collect for wasting time

90+2 mins – YELLOW CARD

Haaland and Onana dey booked sake of di heavy hand wey Onana take catch ball dem throw at am but Erling Haaland also foul am.

90 mins – INJURY TIME

City dey sooo close with five minutes added time

89 mins – Ederson stop Lukaku header from point blank range as Ruben Dias try score im own di ball go wide.

88 mins – All Inter players apart from keeper don dey City half of di field now.

85 mins – City get corner wey Andre Onana catch with ease. Haaland stand for im front like e wan put fear for im bodi.

84 mins – SUBSTITUTION

Henrikh Mkhitaryan and Danilo D’Ambrosio rey replace Matteo Darmian and Hakan Calhanoglu.

83 mins – YELLOW CARD

Lukaku don gbab yellow card say im tackle City captain Ilkay Gundogan,

82 mins – SUBSTITUTION

John Stones don get injury and Kyle Walker dey replace am.

79 mins – Romelu Lukaku head ball to Raoul Bellanova wey cross but e go corner. Nicolo Barella shot go ova di bar.

78 mins – Phil Fodden almost win dis match for City as im dodge defender only to carry shot give Andre Onana ball.

77 mins – City get free kick. Ilkay Gundogan shoot but Inter clear am.

76 mins – Denzel Dumfries and Alessandro Bastoni don comot for Robin Gosens and Raoul Bellanova to enta for Inter.

74 mins – Rodri goal don ginger Inter as Lautaro Martinez give Lukaku ball wey im shoot straight to Ederson. Kyle Walker dey ready imself.

72 mins – Manuel Akanji no do well as e lose Federico Dimarco run and misjudge di ball bounce.

70 mins – Federico Dimarco carry header ova Ederson but e land for cross bar go back Dimarco wey head di ball to Lukaku leg

68 mins – GOAL! – Man City 1-0 Inter Milan

Rodri don give us di first goal of di match.

67 mins – Erling Haaland catch ball for 30 yards but Alessandro Bastoni stop am as e reach box.

65 mins – Pushing plenti for corner and referee give Inter corner wey dem waste.

62 mins – Jack Grealish dey try pass ball to John Stones but e no work.

60 mins – YELLOW CARD

First yellow go to Nicolo Barella wey foul Phil Fodden and Ruben Dias head di free kick ova di bar.

58 mins – Inter miss chance as Manuel Akanji leave ball to meet Ederson but e no go meet am. Lautaro Martinez shoot but Ederson save.

58 mins – Lukaku connect di ball with header but e no make brain.

57 mins – SUBSTITUTION

Romelu Lukaku don come replace Edin Dzeko

56 mins – Lautaro Martinez shot from 30 yards dey blocked.

55 mins – John Stones get correct feet to find Ilkay Gundogan but three Inter players crowd am and di chance don go.

53 mins – Phil Fodden free kick cross dey poor and waka pass evribodi. Manuel Akanji no fit even keep am for field.

50 mins – Inter keeper Andre Onana give ball to Bernardo SIlva but City no use am well.

48 mins – Inter Federico Di marco catch Bernardo Silva elbow for back but e dey okay.

47 mins – John Stones wan pass Erling Haaland ball but defender first catch am. Na only nine times e don touch ball.

46 mins – KICK OFF!

SECOND HALF

HALF -TIME: First half don end.

45 mins – INJURY TIME

Two minutes dey added.

44 mins – Phil Fodden free kick go meet Rodri for di oda side and im cross be like im hit im oda leg come roll away.

42 mins – City pass ball from one side go di oda and dem just dey find space. But Inter defence dey gidigba.

40 mins – Some crunching tackles dey fly up and down.

37 mins – Inter dey do beta pressing and closing down and e be like di tactic dey work for dem.

35 mins – SUBSTITUTION

Kevin de Bruyne don comot field and Phil Fodden replace am. KDB bin cross ball and pain show for im face.

34 mins – City don get 63.5% possession so far and Kevin de Bruyne find John Stones with pass.

33 mins – Kevin De Bruyne still dey for field dey find ball. But for side, Phil Fodden don comot tracksuit dey warm up.

30 mins – Kevin De Bruyne don fall and e need treatment. E fit be kasala for City ooo!!!! E be like na im hamstring.

27 mins – Ogbonge chance for City to score as Kevin De Bruyne control ball give Haaland wey shoot for goal before Andre Onana shift am comot.

26 mins – Haaland stick im legs high for air to give long ball to Kevin De Bruyne wey slip.

23 mins – Ilkay Gundogan tackle Federico Dimarco but game continue. Jack Grealish and Nathan Ake fail to create beta move from di edge of di box. Dimarco fit get treatment.

20 mins – Nice pass around di box and Inter Captian Marcelo Brozovic shoot well outside di box.

19 mins – Erling Haaland head ball give Jack Grealish for left wing but Fraanesco Acerbi defend am well-well.

16 mins – City neva gallant yet at all.

15 mins – Di corner no land and enta di mix but City dey clear and e dey go back to Inter keeper.

Two times now Inter wing-backs dey cause City wahala.

12 mins – Ederson tink say ball wey enta box don comot play but e get am wrong let am bounce, wey cause Lautero Martinex to head am back for byline but no pesin dey to turn am to goal.

11 mins – Beta header by Ruben Dias wey Federico Dimarco cross carry away. Na clearance from Ederson make am turn throw in for Inter.

5 mins – Bernardo Silva curl shot waka just wide off di far post.

3 mins – Erling Halaand put di ball over di bar and e even dey offside.

2 mins – Inter go straight to attack but Edin Dzeko lose im footing for di right wing.

1 min – KICK-OFF

First Half

Di first ever match between Manchester City and Inter Milan don start.

Man City fans

Getty Images

Manchester City Team line up

  • Ederson
  • Akanji
  • Stones
  • Dias
  • Ake
  • Rodrigo
  • Gundogan (C)
  • De Bruyne
  • Bernardo
  • Grealish
  • Haaland

SUBS

  • Ortega Moreno
  • Carson
  • Walker
  • Phillips
  • Laporte
  • Alvarez
  • Gomez
  • Mahrez
  • Perrone
  • Foden
  • Palmer
  • Lewis
Inter Milan fans

Getty Images

Inter Milan Team line up

  • Onana
  • Darmian
  • Acerbi
  • Bastoni
  • Dumfries
  • Barella
  • Brozovic
  • Calhanoglu
  • Dimarco
  • Martinez
  • Dzeko