Nigeria Presidential Election 2023: Bola Tinubu, Peter Obi, Atiku Abubakar, Rabiu Kwankwaso – presidential candidates wey dey hope to replace Buhari

Di Independent National Electoral Commission (Inec) don release di final list of presidential candidates of different political parties for di 2023 presidential election.

Inec release di list on Tuesday – both physically for dia notice board and online.

“Di published list contain di names of candidates validly nominated for national elections at di close of party primaries and di period for withdrawal and substitution of candidates,” Festus Okoye, di commission official tok for statement.

All 18 parties get candidates

Prominent on di list na di candidates of di Peoples Democratic Party (PDP), Atiku Abubakar; All Progressives Congress (APC), Bola Tinubu, Peter Obi of di Labour Party (LP), Social Democratic Party(SDP) Prince Adewole Adebayo and odas.

Okoye say “Di Commission approve di final list of candidates for national elections (Presidential, Senatorial, and Federal Constituencies) pursuant to section 32(1) of di Electoral Act 2022 and Timetable and Schedule of Activities for di 2023 General Election.”

Di list get names, age, origin and qualification of di candidates – dem also list di names and details of dia vice presidential candidates.

Inec also publish list of candidates for national assembly elections across Nigeria.

Doz wey dey di list na;

Asiwaju Bola Tinubu (APC)

Asiwaju Bola Tinubu na former Lagos state govnor, South west Nigeria.

Di two term govnor bin also serve as senator during di brief third republic for Nigeria.

Dis na im first time to contest di presidential election.

Na im party dey currently in office so dat one make dem di party to beat.

Im vice presidential candidate na former Borno statet govnor, Kashim Shettima.

Atiku Abubakar (PDP)

Atiku Abubakar na man wey don tey for politics. Im don attempt to be president several for different political parties.

2023 go be di sixth time wey Atiku go seek to become Nigeria president after first showing interest for 1993 even though e no get im party ticket at di time.

Atiku na former Nigeria Vice President and e beat Rivers state govnor Nyesom Wike to emerge candidate of di Peoples Democratic Party (PDP).

Di Adamawa state born businessman contest general elections for 2007, 2011 and 2019 elections.

Im vice presidential candidate na Delta state govnor Ifeanyi Okowa.

Rabiu Musa Kwankwaso (NNPP)

Rabiu Kwankwaso na di former govor of Kano state, North west Nigeria wia e introduce free education for local residents

Di two term govnor also serve as senator afta e leave office between 2015-2019.

Im bin serve as minister of defence under Olusegun Obasanjo presidency and vow to tackle di kontri various security crises by recruiting extra 750,000 sojas to take di size of di army to one million.

Di 66 year old dey popular for im red cap – 2023 go be di third time wey Kwankwaso go dey seek Nigeria highest office but di oda two attempts end for primaries.

Im vice presidential candidate na Odiri Idahosa.

Peter Obi (LP)

Peter Obi na former govnor of Anambra state for southeastern Nigeria wia im get strong record. E also get active support base for social media.

Im become flagbearer wen Labour Party hold dia convention for Asaba Delta state last month. Di 61 year old dey portray im sef as ‘Mr Clean’ – some tin wey many Nigerian politicians no fit boast about.

Former aspirant himself Professor Pat Utomi step down for Obi wia e also tok say Obi deserve to get chance to govern Nigeria.

Dis na di second time wey di two term govnor go dey ontop presidential ticket since – for 2019 e serve as running mate to Atiku Abubakar of di PDP for 2019 elections, na dia party come second.

Im vice na Yusuf Baba-Ahmed, a former Senator from Kaduna state.

Prince Malik Ado-Ibrahim (YPP)

Prince Malik na Prince from Kogi state, North central Nigeria. Im na di son of Ohinoyi of Ebiraland and na billionaire wey get energy company Bicernegy.

Prince Malik na also di founder of Formula One team Arrows A20. For 2020 tori of im marriage to billionaire daughter Adama Indimi grab serious attention at di time.

Im dey represent Young Progressive Party (YPP) and im vice presidential candidate na Enyinna Kasarachi.

Ado-Ibrahim promise to;

  • Harness di huge resorces and talents for Nigeria human capital wealth
  • Provide sufficient funds to supply varous types of weapons for defence, deterrence and retaliation
  • Diversify di national economy by promoting solid minerals development
  • Promote national consciousness and Nigerian cultures.

Omoyele Sowore (AAC)

Omoyele Sowore na founder and publisher of US-based media, Sahara Reporters. Dis go be di second time wey Sowore go run for presidential election afta also running in 2019.

Di publisher/activist bin chop arrest few years ago unto ‘Revolution Now’ protest wey e bin wan organise across Nigeria. Im vice presidential candidate na Magashi Garba.

E say im go;

  • Build strong and productive economy wey go work for all
  • Set up inter-agency “special and violent crimes task force” to respond to kidnappings and oda security emergencies as e dey happun.
  • Transform di kontri into a truly and open democratic nation
  • Show commitment to di struggle for di total liberation of di Nigerian pipo.

Kola Abiola ( PRP)

Oga Kola na di eldest son of late business tycoon and politician, late Moshood Abiola.

Kola just like im father dey into business and e defeat former MD of Bank of di North Falalu Bello to grab di presidential ticket of PRP.

Dis no be di first time wey Kola go dabble into politics as e don happun before.

Di 59 year old go dey hope say e fit win dis time around.

Im vice presidential candidate na Zego Haruna.

Hamza Al- Mustapha (AA)

Hamza Al- Mustapha na former chief security officer to late head of state General Sani Abacha.

Al-Mustapha wey serve over 10 years for jail afta di death of Abacha defeat im only opponent Samson Odupitan to emerge candidate of AA.

Di retired Major from Yobe state don contest for Nigeria presidency before but go dey hope say dis time around go beta pass last time.

Im vice presidential candidate na Johnson Chukwuka.

e promise to;

  • Stabilise di economy and promote agriculture
  • Re-enforce di National Security Council to handle all matter of national security.
  • Give priority to di security and welfare of di pipo
  • Tackle corruption by holding corrupt official accountable.

Professor Christopher Imumulen (AP)

Christopher Imumulen na professor of Engineering.

Im na 39 years old – di youngest presidential candidate for di election.

Im begin im career as a gas plant engineer for BOC Gases Nigeria Limited for 2005.

Professor Christopher according to im profile get two Phd degrees for Engineering research and Educational Management.

Im vice presidential candidate na Bello Maru.

Dumebi Kachikwu (ADC)

Dumebi Kachikwu na di founder of Roots Television.

Im defeat favourite for di ticket Kingsley Moghalu, a former Central bank oga to emerge.

Im vice presidential candidate na Buhari Ahmed.

Peter Umeadi (APGA)

Peter Umeadi na retired Judge and a professor of Law.

Im na former chief judge of Anambra state for eight years.

Na only oga Peter show interest and all oda party members agree to allow am contest for Nigeria presidency for 2023.

Im vice presidential candidate na Mohammed Koli.

E promise to;

  • Employ evri means – diplomatic, political, economic, social and cultural – to advance di image of di Federal Republic of Nigeria as di spiritual home of di black pipo of di world.
  • To raise di quality of life of di common pipo and ensure say all Nigerians get access to di prosperity of di century.
  • Ensure say di Armed forces get professional training, disciplined and equipped wit evri modern engine of war.
  • Immediately upgrade di salaries, barracks, uniforms and personal welfare of both di rmed forces and di police.

Okwudili Anyajike (NRM)

Oga Okudili na im emerge winner from di primaries wey National Rescue Movement do for Abuja.

Di businessman poll 180 votes to defeat im closest rival Professor Benedicta Egbo wey get 30 votes.

Im vice presidential candidate na Kyabo Muhammad.

Sani Yusuf (ADP)

Im na politician and businessman from Kano state, North west Nigeria.

Yusuf don tey for politics and im say im plan na to end ‘systemic corruption’ for Nigeria. Im vice presidential candidate na Udo Okoro

Im promises include;

  • To spend up to 15% of di annual budget on di education sector while making susbstantial investments in training quality teachers at all levels of di educational system.
  • Diversify di economy through innovation, industrialization and technological development in agriculture
  • Proactively support transparency and accountability by goment insitutions and officials.

Ojei Chichi (APM)

Princess Chichi na di only female presidential candidate for di 2023 presidential election.

She na administrator and politician from Delta state, South south Nigeria.

Her vice presidential candidate na Ibrahim Mohammed.

Princess Chichi Ojei na di daughter of billionaire and entrepreneur, Emmanuel Isichei Ugochukwu Ojei.

She be di Corporate Financial Specialist for Nuel Ojei Holdings, one company wey her father establish wey get interest for major sectors of Nigeria economy like automobile, telecommunications, banking, oil and gas and many others.

Di 44-year-old Delta State indigene bin emerge as di presidential candidate of di Allied Peoples’ Movement (APM) afta di party endorsement.

Her campaign office describe her as a “visionary leader and politician, ogbonge administrator and pesin wey sabi business well-well.”

According to her LinkedIn account, she receive education from ogbonge institutions across di world.

She bin attend American International School for Lagos. Institute Leroy for her secondary school education. She attend Northeastern University for her Bachelor Degree for Business Administration and Regent Business School for her Master’s Degree in Business Administration.

Nnadi Osita (APP)

Im vice presidential candidate na Hamisu Isah.

Adenuga Oluwafemi (BP)

Sunday Oluwafemi Adenuga na one of di 18 candidates wey dey contest for di 2023 presidential elections. Im vice presidential candidate na Mustapha Turaki.

Dem born di 58-year-old politician for Lagos state and e don serve for various ministries of goment. For 2019, dem promote am to di post of Director of Audit for di Office of di Auditor-General of di Federation.

Oga Adenuga tell tori pipo say if dem elect am as di president of Nigeria, im go pursue one working Nigeria. E also say;

  • Revive di economy to work for evri bodyby investing massively in infrastructural development.
  • Prioritize di use of ‘made in Nigeria products
  • Increase security for di north-east region and concentrate investment in solar energy for some part of di kontri.
  • Declare state of emergency on health

Adebayo Adewole (SDP)

Adebayo Adewole na Lawyer, politician and business man from Ondo state, South west Nigeria.

Na im be di presidential candidate of di Social Democratic Party (SDP) – im running mate na Buhari Yusuf.

Im na di founder of Kaftan TV. and im promise a restructured, equitable and functional Nigerian economy.

  • A dynamic, productive, transformed and sustainable economy
  • A just, fair, egalitarian and peaceful nation.
  • A conscious effprt to open di politcal space for greater inclusion of youth and women in governance.

Daniel Nwanyanwu (ZLP)

Daniel Nwanyanwu na di National chairman of Zenith Labour Party.

Nwanyanwu emerge Presidential candidate for di special convention of di party for Abuja.

Im na politician and banker from Imo state, Southeast Nigeria.

Im vice presidential candidate na Abubakar Ramalan.