How Eddie Nketiah late goal give Arsenal win over Man Utd

Gabriel and Nketiah

Reuters
Gabriel and Nketiah dey celebrate

Arsenal retain control of di Premier League title race afta Eddie Nketiah 90th-minute winner give dem a dramatic victory over Manchester United inside di ogbonge game for di Emirates Stadium.

Manchester City earlier win over Wolverhampton Wanderers apply pressure on di Gunners but dem respond with character and quality, even afta dem go behind, to secure a five-point advantage at di top with a game in hand.

United man of di moment Marcus Rashford fire home one ogbonge right-foot strike from 25 yards to give dem a 17th-minute lead.

Arsenal respond strongly and level seven minutes later wen Granit Xhaka cross create a heading opportunity for Nketiah, wey go in ahead of Aaron Wan-Bissaka for di far post.

Bukayo Saka angled drive put Arsenal ahead eight minutes afta di break but dia advantage last only six minutes, as Lisandro Martinez head in im first goal for di club afta keeper Aaron Ramsdale drop a corner.

Arsenal look di more likely winners in di closing stages, with Saka wey hit di post and Nketiah wey dey denied by David de Gea ogbonge save.

Di pressure pay off in di closing moments wen Nketiah – striker wey dey do ogbonge job to fill in for injured Gabriel Jesus – turn in from close range to cause serious hala and celebration for Emirates Stadium.

Rashford score

Getty Images
Rashford score

Di game as e happun live

FULL TIME

Arsenal 3-2 Man Utd

All over.

Awesome game!!!.

90+2 min: Eddie Nketiah take di ball into di corner.

90+1 min: SUBSTITUTION

Alejandro Garnacho on for defender Raphael Varane.

Rob Holding replace Martin Odegaard for Arsenal.

90 mins: Dem give am.

Emirates wake up again.

Arsenal don win am with a minute to go.

89 mins: GOAL!

Arsenal don score oohhhhh. Eddie Nketiah fit don give di win to di Gunners.

Eddie Nketiah with di clever finish from close range.

Dem dey check am…

86 mins: CLOSE!

Christian Eriksen shot from di angle deflect go wide.

85 mins: Corner to Arsenal again.

But Gabriel effort bounce through to David de Gea.

84 mins: David de Gea to di rescue for Manchester United as im team-mates fail to clear di free-kick. E drop for Eddie Nketiah, wey im low shot from 10 yards out dey stopped by di Spaniard.

83 mins : YELLOW CARD

Luke Shaw hold Bukayo Saka somehow and e collect yellow.

82 mins: SUBSTITUTION

Arsenal 2-2 Man Utd

Debut for Leandro Trossard. E dey replace Gabriel Martinelli.

81 mins: Bruno Fernandes need attention from di physio.

79 mins: From Aaron Wan-Bissaka on Gabriel Martinelli. David de Gea punch di corner away.

78 mins: Gabriel Martinelli shot dey blocked by Lisandro Martinez. Corner.

76 mins: Arsenal panic small for back and Christian Eriksen almost take advantage of am but Aaron Ramsdale clear am.

74 mins: Cross from Takemiro Tomiyasu dey cleared by Raphael Varane.

71 mins: United change, Antony off and Fred on.

70 mins: Bukayo Saka curl in one fine ball but e hit di foot of di post.

66 mins: Granit Xhaka pass to Martin Odegaard, but di shot dey blocked by Christian Eriksen.

64 mins: Bukayo Saka dey provide di danger again, e roll am give Eddie Nketiah but di striker no fit finish.

Martinez celebrate im goal

Reuters
Martinez celebrate im goal

58 mins: GOAL!

Man Utd retaliate.

Na mistake from Aaron Ramsdale for di corner.

E drop for Lisandro Martinez to head am to finish into di net.

Gabriel do im best to keep am out, but e no fit.

57 mins: United earn a corner.

55 Mins: United go to di oda end and almost level immediately.

Marcus Rashford manage to somehow create space and fire shot but Aaron Ramsdale stop am.

53 mins: GOAL!

Arsenal 2-1 Man Utd

Di Gunners don take di lead wit Bukayo Saka goal.

Bukayo Saka get di ball out wide, and Christian Eriksen no fit stop am,

Saka shift am, den ping am into a glorious low finish wey enta into di far corner of di net, David de Gea no fit stop am.

52 mins: Martin Odegaard create a throughball towards Granit Xhaka, but di Argentine World Cup winner Lisandro Martinez slide in to challenge am in di six yard box.

49 mins: PENALTY APPEAL

Gabriel go down in di box with Scott McTominay dia.

47 mins: Antony dey booked say e set leg for Oleksandr Zinchenko.

KICK OFF!

Arsenal 1-1 Man Utd

SECOND HALF

SUBSTITUTION

Ben White dey replaced by Japan international Takehiro Tomiyasu.

HALF TIME!

Arsenal 1-1 Man Utd

45+2 mins: CLOSE!

Di stadium wake up wen Arsenal get on di attack.

Bukayo Saka see im two shots dey blocked by Luke Shaw.

44 mins: United dey take dia time wit one free-kick and dey test di patience of referee Anthony Taylor, wey dey point to im watch as di home fans dey shout in frustration.

39 mins: United find space on di counter again but Bruno Fernandes no find im team-mate with im cross.

37 mins: United get a chance to break with three on three, but Antony pass to Marcus Rashford dey very poor.

33 mins YELLOW CARD!

Arsenal dey play through United players and get one free-kick wen Luke Shaw push Bukayo Saka.

Mikel Arteta dey ginger and collect yellow card.

31 mins: Dem dey block Arsenal efforts for di box, but dem dey get into good positions.

Martin Odegaard cross but dem block am.

28 mins: CLOSE!

Antony cut in from di right and play am to Scott McTominay outside di area and di midfielder side-foot effort dey pushed to safety by Aaron Ramsdale.

24 mins: GOAL!

Arsenal 1-1 Man Utd

Eddie Nketiah score.

Granit Xhaka send cross to di back post for Eddie Nketiah to fire am and draw im side level.

19 mins: YELLOW CARD!

Marcus Rashford dey cause problems for Arsenal now.

Ben White bring am down and collect di first booking of di game.

17 mins: GOAL!

Arsenal 0-1 Man Utd

Marcus Rashford goal don give di Red Devils lead.

Di England international free imsef away from Thomas Partey beautifully with quick feet, di space open up and Rashford fire shot from range, e hammer in a 25 yard strike.

14 mins: Aaron Wan-Bissaka lose im bearings for di back post from Bukayo Saka cross and nearly put am inside im own net.

Di corner dey headed out by Scott McTominay.

10 mins: Martin Odegaard again run away with di ball afta Bruno Fernandes give am away.

But di Arsenal skipper no fit find di run of Gabriel Martinelli as e attempt a through ball.

8 mins: Gabriel Martinelli, cut inside of Aaron Wan-Bissaka but e curl di ball go wide.

7 mins: Bruno Fernandes get one ball ahead of Aaron Ramsdale and go down.

E call for penalty, referee Anthony Taylor and VAR say no.

3 mins: Close!

Arsenal Martin Odegaard find Thomas Partey towards di near post, but di Ghanaian play am wide.

2 min: Gabriel Martinelli delivery dey poor, Bruno Fernandes clear am from di front post.

Martin Odegaard shot dey blocked.

Anoda corner for Arsenal.

I min: Arsenal win corner in di first minute.

Kick-off!

Arsenal 0-0 Man Utd

Saka celebrate im goal

Getty Images
Saka dey celebrate with team mate

Arsenal XI

Bukayo Saka and Mikel Arteta

Getty Images

Arsenal XI: Ramsdale, White, Partey, Gabriel, Saka, Odegaard, Martinelli, Saliba, Nketiah, Xhaka, Zinchenko.

Subs: Turner, Tierney, Smith Rowe, Holding, Tomiyasu, Trossard, Vieira, Sambi Lokonga, Marquinho.

Man Utd XI

De Gea, Martinez, Fernandes, Rashford, Eriksen, Varane, Antony, Shaw, Weghorst, Wan-Bissaka, McTominay.

Subs: Heaton, Lindelof, Maguire, Malacia, Fred, Pellistri, Elanga, Garnacho, Mainoo.

Head to Head (Before today game)

Arsenal Total Wins: 17 Home 13 Away 4

Man Utd Total Wins: 26 Home 18 Away 8

Played 61 Draws 18 Recent Meetings

Past recent meetings

Sunday 04 September 2022: Old Trafford – Man Utd 3-1 Arsenal

Saturday 23 April 2022: Emirates Stadium – Arsenal 3-1 Man Utd

Thursday 02 December 2021: Old Trafford – Man Utd 3-2 Arsenal

Saturday 30 January 2021: Emirates Stadium – Arsenal 0-0 Man Utd

Sunday 01 November 2020: Old Trafford Man Utd 0-1Arsenal