List of di 20 richest football clubs for di world

Kevin De Bruyne

Getty Images

More dan half of di world richest clubs by revenue na from the English Premier League, according to analysis by Deloitte. 

Na Eleven Premier League clubs make up di top 20 in dia Money League study from di 2021-22 season.

Dis na di first time in di study in 26 years wey more dan half of di clubs come from di same league.

Champions Manchester City retain top spot, making 731m euros (£619.1m), ahead of Real Madrid (713.8m euros).

Liverpool rise to third from seventh, while Manchester United, Chelsea, Tottenham and Arsenal also make di top 10, with West Ham, Leicester, Leeds, Everton and Newcastle in the top 20.

Di top 20 clubs make 9.2bn euros (£7.82bn), a 13% increase from 2020-21.

Dem say di increase dey largely down to di return of fans to stadiums for di first full season afta Covid-19 restrictions, with matchday revenue rising from 111m euros to 1.4bn euros. 

Five of di Premier League ‘big six’ – Chelsea, Liverpool, Manchester City, Manchester United and Tottenham Hotspur – report revenue increase of 15% or more. 

‘Na case of wen all 20 premier league clubs go make top 30’

Na premier league clubs dominate di list

BBC Sport
Liverpool move from seven to third richest club for di world

Man City bin enta di top five for di first time in 2015-16, before topping table last season.

Dia impressive form for pitch see dem win back-to-back titles under Pep Guardiola and dem post Premier League commercial revenue record of 373m euros (£317.05m).

Liverpool na di biggest mover, rising from seven to third, to achieve dia highest ever position and overtake Manchester United in di rankings for di first time.

Dia run to di Champions League final, wia dem lose 1-0 to Real Madrid, see dem gain additional broadcast revenue. 

Dem also generate more dan 100m euros (£85m) from matchday revenue for di first time.

Arsenal become di first side to enta di top 10 since 2018-19, dis na sake of rise in matchday revenue, while Leeds enta for di first time since 2002-03 and Newcastle re-enta. 

Both clubs report higher matchday and commercial revenue dan many oda English clubs.

If dem extend di Money League to top 30 e go be 16 Premier League clubs included, with five clubs from La Liga, three from both Serie A and di Bundesliga and one from Ligue 1.

All of di teams from di oda European leagues compete for Uefa club competitions in 2021-22. 

Sam Boor, wey be director for Deloitte Sports Business Group, add:

“Di Premier League financial power dey unlikely to be challenged for di coming seasons. 

“Dis particularly dey show as di clubs continue to attract international investment.”

“For now, na likely a case of not if, but wen, all 20 Premier League clubs go appear in di Money League top 30.”

Di top 20 clubs

  • Manchester City
  • Real Madrid
  • Liverpool
  • Manchester United
  • Paris St-Germain
  • Bayern Munich
  • Barcelona
  • Chelsea
  • Tottenham Hotspur
  • Arsenal
  • Juventus
  • Atletico Madrid
  • Borussia Dortmund
  • Inter Milan
  • West Ham United
  • AC Milan
  • Leicester City
  • Leeds United
  • Everton
  • Newcastle United