Alika Ogorchukwu: ‘Di pain dey too much for me’ – Nigerian vendor wife call for justice afta killing of her husband for Italy

Wife of Alika Ogorchukwu, di Nigerian street vendor wey dem kill for Italy dey call for justice.

Ogorchukwu wey be 39 years old bin dey sell goods on Friday for di main street of Civitanova Marce, one beach town for di di Adriatic Sea wen im attacker grab im crutch and strike am down according to police.

For interview with tori pipo Africa news on Sunday, im wife say she need justice for her husband.

“Me I need justice for my husband na wetin I want, becos di pain dey too much for me, I need justice.” She tok.

Di death shock pipo as nobody bin try stop di attack but instead ome pipo bin dey video di attack wey happun on Friday July 29 for Civitanova Marche town centre.

Dii video show one white man hold Ogorchukwu for ground wit force dey fight am.

Ogorchukwu bin dey struggle for im life as di white man pin am for ground.

Police don arrest one 32-year-old Italian on di suspicion of murder and robbery.

Di video of di attack wey full Italian news websites and social media – shock di community, many point shock by “di I don’t care attitude” of witnesses.

Call for justice

Di victim wey im name na Alika Ogorchukwu, na married father of two.

Im wife, Charity Oriachi, no fit hold her tears as she tell tori pipo how dem show her im body for ground.

Reports say begin start to dey sell goods for street afta e get car accident and lost im job due to leg injuries.

On Saturday, hundreds of pipo from di local Nigerian community enta di streets of Civitanova Marche, for Marche region, to demand justice.

Italian politicians too don condemn di attack

Enrico Letta, di leader of di left-wing Democratic Party, say wetin happen dey “shocking”.

“Unheard of ferocity. Widespread indifference. No justification,” e write for tweet.

Right-wing leader Matteo Salvini say “security no get colour” and “e need to return as pesin right.”

Wetin Nigeria goment tok?

Nigeria Ambassador to Italy Mfawa Omini Abam don condemn di attack and send condolence message to Ogorchukwu wife and di rest of im family.

Di embassy say dem dey currently work wit relevant Italian authorities to ensure say dem get justice for dis mata and also provide help to Ogorchukwu family.

Ambassador Mfawa Omini Abam advise members of Nigerian community for Italy to remain calm and avoid to take di laws into dia hands.