Eid al-Fitr moon sighting Saudi Arabia: Ramadan ‘fasting continue’ Sultan of Sokoto tok wen to end

Sultan of Sokoto don declare say Thursday na Eid-al-Fitri for all Muslims to celebrate di end of Ramadan for Nigeria.

Alhaji Sa’ad Abubakar III wey be President-General Nigeria Supreme Council for Islamic Affairs declare dis on Tuesday night.

Di Sultan announcement mean say Ramadan fasting dey continue on Wednesday.

Eid al-Fitr 2021 Sallah celebration wey go end di 30 days of Ramadan fasting, go now happun either on Thursday.

Sighting of a new moon for di month of Shawwal happun on Tuesday but dem no find di crescent.

For Saudi Arabia, di Kingdoms Moon Sighting Committee wey dey Tumair observatory no see rescent moon on Tuesday.

Eid al-Fitr for start [on Wednesday] one day earlier if to say dem see di moon.

Di Eid al-Fitr celebrations mark di end of a month of piety and all-day fasting for 1.8 billion Muslims all over di world.

For Nigeria Federal goment don declare Wednesday 12 and Thursday 13 May, 2021 as Public Holidays for dis year Eidul-Fitr.