Muhammadu Buhari: Nigeria President go harder on criminals, insist to shoot anyone wit AK-47 illegally

Nigeria President Muhammadu Buhari vow to go harder on criminals, insist to shoot anyone wit AK-47 illegally.

Na Thursday inside Abuja President Muhammadu Buhari emphasize say security chiefs don receive marching orders to go harder on criminals, including to shoot anyone found illegally with AK-47.

President speak for one meeting wit di National Council of Traditional Rulers of Nigeria for Aso Rock Presidential Palaca, wey Sultan of Sokoto, Alhaji Muhammad Sa’ad Abubakar III and Ooni of Ife, Oba Adeyeye Enitan Ogunwusi join-hand as chairmen of di council.

”But wetin dey surprise pesin na wetin dey happen now in di North West wia di same pipo, wit di same culture dey kill each other, dey take dia livestock and burning properties.

”As a result of dat, we bin hold one four-hour meeting of di National Security Council wey Ministers of Internal Affairs, Defence, Foreign Affairs, Service Chiefs, Chief of Defence Staff, the Inspector-General of Police and others attend and we bin give clear instructions.

”One thing wey we get to di press hand for, wey I read myself na say anyone wit AK-47 gun dem go shoot am.

”Dis na because AK-47 suppose be be registered na only given to security officials. Di President tok.

Dis meeting na security chiefs including the National Security Adviser, Major-General Babagana Monguno (Rtd), Inspector General of Police, Mohammed Adamu, the Director-General of Department of State Services, Yusuf Bichi, and the Director-General of National Intelligence Agency (NIA), Ambassador Ahmed Rufai Abubakar attend am.

Di President, wey apprise di meeting with efforts by di goment to improve di security situation inside di kontri, say im goment don record appreciable successes inside di North-east and South-South parts of di kontri.

”We close di borders for some years but di intelligence report I dey get on a daily basis show say those wey dey do di abductions, di killings and so on never still run out of arms and ammunition,” D president add.

Di President say im belle no sweet on di attacks on police stations and killings of security personnel by criminals, warning say no investor go invest in a kontri wey dey unsafe.

President Buhari for statement wey in tok to pesin Femi Adesina release also speak on di need for traditional rulers to use their roles and positions as bridge builders in each of dia communities to complement goment efforts at ensuring peace and security.