Abiola Ajimobi, di former govnor of Oyo State south-west Nigeria die from multiple organs failure following complications from COVID19 infection and BBC Pidgin find out say im burial go now take place for on Sunday
Di family bin say dem go bury Ajimobi wey die at di age of 70 on Friday for Ibadan, di Oyo State Capital, but Bolaji Tunji wey be di PA to di late Senator Abiola Ajimobi tok say dem pospone am sake consultation wit Lagos and Oyo State goments.
“Di burial e go dey observed privately so dat e go dey in line wit di Nigerian Centre for Disease Control (NCDC) guidelines.” Tunji add on Friday.
“If notin change last minute, dem go bury am for Senator Ishaq Abiola Ajimobi Central Mosque inside Oke Ado, Ibadan at 12 O’clock for afternoon on Sunday, 28th of June, afta di traditional Muslim prayers.” Oga Tunji tok for statement.
Na one close aide of di Senator and anoda family member first confam Ajimobi death to BBC on Thursday evening of 25 June.
Senator Abiola Ajimobi die for First Cardiologist Consultant; one private hospital inside Lagos, wey goment give approval to operate as Coronavirus COVID19 care facility, according to Professor Akin Abayomi, di Lagos State Commissioner for Heath.
Oda of im close friends don begin post sorry messages of im death. Nigeria President Muhammadu Buhari mourn di death of Ajimobi for statement from im office.
STATE HOUSE PRESS RELEASE
PRESIDENT BUHARI MOURNS FORMER OYO STATE GOV, ABIOLA AJIMOBI#Thread
— Presidency Nigeria (@NGRPresident) June 25, 2020
Otunba Adebayo Christopher Alao-Akala, di former Oyo govnor wey Abiola Abiola Ajimobi succeed tell BBC im dey in shock over di death of di man wey take over from him.
Oga Ajimobi dead mata land afta di former govnor spend weeks in coma inside intensive care for coronavirus complications, according to wetin Akin Alabi wey be federal lawmaker and political associate of di late senator tok.
https://www.facebook.com/bbcnewspidgin/videos/256719265626783
Who be Abiola Ajimobi?
Dem born am as Isiaka Abiola Ajimobi on 16 December, 1949.
Na for im state of origin Oyo, im do im primary and secondary education.
Ajimobi travel go America for im university education wia im study Business Administration and Finance for State University of New York and later do MBA for State University, Illinois.
- Ajimobi or Giadom, who be di real acting national chairman of APC? – See wetin we sabi
- APC chop fresh court order on Giadom position as acting national chairman
E marry Florence 1980 and dem get five children.
Im political career begin for 2003 when im bin serve as Deputy Minority leader for Senate. By 2007 im contest to be govnor of Oyo State but e no win am.
For 2011, e become govnor for di first time, and later e break record for Oyo to be di first pesin to do two democratic terms back-to-back for di state.
Around 18 June, rumours bin dey fly upandan say di lawmaker and former govnor don die, only for im daughter Fatima Ganduje-Ajimobi to comot for social media to deny am.
Inside interview with BBC Yoruba on Tuesday, 16, June , 2020, im tok-tok pesin Bolaji Tunji tok say ‘Ajimobi say im go settle all di wahala wey dey di political party during dia National Executive Council (NEC) meeting’.
Oga Tunji also bin deny all di rumours wey dey fly around say senator Ajimobi dey coma and dey receive treatment for hospital.