Nigeria President Muhammadu Buhari don commission di Lagos-Ibadan railway line to begin commercial operations for di kontri.
Di President for di launching of di Railway Station wey dey Ebute Metta describe di achievement as “anoda landmark for di drive of im administration to revitalize di railway system and establish am as a choice of transportation for both passengers and loads.”
Di Ebute Metta Station, wey pipo sabi as Mobolaji Johnson Station, na di largest railway station for West Africa with a holding capacity of 6000 passengers.
For inside statement wey di Special Adviser to di president on Media, Femi Adeshina sign, e say goment go continue to make rail system priority as transport na backbone wey go change di industrial and economic activity for di kontri.
“President Buhari dey committed to developing a modern national railway network wey go connect every part of Nigeria, and promote trade, travel, tourism, commerce and national integration.” E tok.
Di statement also point out di benefits of di Lagos-Ibadan corridor plus other railway projects wey dey go on across di kontri.
How di railway projects go benefit Nigerians
On how di railway line go take benefit di kontri, President Buhari say railway lines get plenty economy benefits as e go provide jobs for kontri pipo.
”Dis vital line go establish an end-to-end logistic supply chain for railway transport within its short corridor, Lagos – Ibadan, as goods to di hinterland go now dey transported by rail directly from di Apapa port Quayside straight to di Inland Container Depot wey dey for Ibadan from wia dem go distribute am to oda parts of di kontri.
E add join say, one of di challenges of economic growth for di kontri na because no correct infrastructure dey ground.
Di Lagos – Kano railway project wen dem complete am go link di Kano – Maradi line for Kano state.
- See di new process to apply for Nigerian passport
- Mark Zuckerberg tweet against Buhari Twitter Ban in Nigeria?
“Di connection through rail go position Nigerian ports as di choice for import and export business of di pipo of landlocked Niger Republic.
”Dis go dey beneficial to di economy through employment from new business opportunities and wealth creation.”
Oda railway projects wey dey go on for di kontri
Di President say di Lagos – Kano railway project wen dem complete am go link di Kano – Maradi line for Kano and dem go also complete anoda rail link from di Nigeria southern ports of Lagos to Maradi wey dey Niger Republic.
He note say, di Ibadan-Kano project go get connection to di Tin Can Island port as well as di West – East Coastal rail line from Lagos to Calabar wey go link Onitsha, Benin, Warri, Yenagoa, Port Harcourt, Aba and Uyo.
Di 156km Lagos – Ibadan standard guage standard railway for Lagos wey di president dey commission na di first double track standard gauge railway for West Africa.
Shortly afta e launch di project, President Buhari from go di Energy Nature Light (ENL), Terminal, Apapa Port, Lagos.
Di Speaker House of Representatives, Femi Gbajabiamila, Governor Babajide Sanwo-Olu of Lagos State, Governors of Ekiti, Oyo, Ogun and the Deputy Governor of Ondo, di Minister of Transportation, di Minister of State Transportation, Sen. Gbemisola Saraki, oda Ministers plus some goment officials join am for di event..