How Boko Haram invade rice farms, kill plenty farmers for Borno

Body bags of rice farmers for Borno state

BBC

Boko Haram terrorists on Sunday attack rice farmers inside Borno state for northeast Nigeria wia dem kill plenty of dem as dem dey work on dia farms.

About three farmers wey survive di attack dey receive treatment for hospital.

Dis attack wey happun for evening bring back memories of November 28 2020 when Boko Haram attack dis same location Zabarmani area lead to di death of about 110 farmers.

Some rice farmers wey tok to BBC News Pidgin about wetin happun tok say dia colleagues leave Zabarmani town to Mafa area wia di farms dey only to lose dia lives.

Lawal Wakili yarn say e don tey wey dem dey face threat from Boko Haram but since 2020 dis attack ba di worst dem don suffer.

“Sometimes dem go harass us for farms collect our food and oda times dem go kidnap our pipo for ransom.

“Wetin I hear be say on dia last visit our pipo no give dem anything na wetin make dem vex be dat before dem decide to take dia kain wicked action.”

Anoda farmer Bello Zabarmari say dem use knife on all di 10 victims wey security operatives and vigilantes bring back from di farms on Monday morning – “Dem use knives to cut dem.”

At di moment di commissioner of Police CP Yusufu Lawal and oda top security pipo dey inside Zabarmari town dey try investigate wetin happun.

Di commissioner tok say dem no fit give actual figure of farmers wey dey affected for now as dem dey try get more details.

But ask our reporter to call am back in di afternoon for more details.

Burial of di 10 corpses already recovered go happun around 1:30pm for Zabarmani town.

Memories of 2020 still fresh

Di attack for 2020 also kill plenty farmers wey attract international comdemnation

BBC
For 2020 na about 110 farmers lose dia lives for similar attack

For di farmers dis incident bring back bad memories and fresh fears wey resemble wetin dem pass through three years ago.

For many of dem e take dem months and some a year before dem return to dia farms to go work.

Zabarmari na one di biggest rice producers for di state and many pipo dey rely on dia production to get rice to eat.

“Dis incident na just like wetin happun 2020, di memories just come back fresh.” Bello Zabarmani tok.

Joint troops of di Nigerian Army and di Department of State Services (DSS), successfully stop one close attack on Kano by Boko Haram just two days ago.

For one early mor-mor raid operation on di terrorists’ early hours of Saturday, troops of 3 Brigade Nigerian Army in close cooperation wit di Department of State Services (DSS), conduct well-coordinated raid operation for Gezawa Local Government Area of Kano State.

Di operation aim na to uncover and catch suspected Boko Haram Terrorists (BHT) wey believe be say dey plan one major operation for Kano State.

Di joint troops gbab two boko haram suspects, wey now dey custody.

Source