Authorities respond to questions about where Cameroon president Paul Biya dey

Foto of president Paul Biya of Cameroon

Getty Images

On Tuesday, rumours being spread ova di death of Paul Biya.

Cameroonians president on social media and many international communities bin don dey sympathise wit di kontri.

Di kontri minister of director of di Civil Cabinet, Samuel Mvondo Ayolo say di president dey in good health condition.

Oga Ayolo tok say di president dey for Geneva in Switzerland wia e dey perform official duties.

“Di Civil Cabinet of di Presidency of di Republic reassure Cameroonians and di international community on di excellent state of health. Di Head of State kontinu to exercise im duties in Geneva and e neva depart di city following di visit to Beijing,” e tok.

“Di Civil Cabinet strongly condemn action wey attack freedom of expression wit di sole purpose of misleading local and international public opinions.”

News don dey spread ontop social media say di president die for one hospital for Paris wia e bin dey receive treatment but goment officials from im cabinet don come out to say di president neva die.

Also, minister of labour and social security, Grégoire Owona ontop im X page on Thursday say make di appropriate authorities take up di case to ensure say di fake news carriers go pay for di lie.

“Pipo wey dey try, by various means, to deceive public opinion by announcing di death of di Cameroonian head of state must pay high price for such lie,” e tok.

“Since dem no longer get any human conscience, di appropriate institutions must take action against dis impostors, no matta dia origin or location. We dey in democracy, but malice and hatred get limit.”

Profile of Paul Biya of Cameroon

91-year-old president, Paul Biya na di second longest serving president for di kontri and e don dey power for di pass 41 years.

Di president come into power in 1982, afta Ahmadou Ahidjo wey be di kontri first president afta dia independence in 1960, comot office.

Na di oldest head of state in Africa, wey don dey in power for four decades and many young pipo in di kontri sabi am as dia only leader since birth.

Biya don dey elected into power more dan five consecutives times and many don label am as dictator, as di violence intensify between di Anglophones and Francophones Cameroonians.

Cameroon dey colonised by Germany in 1884, di british and french army force Germans make dem leave di kontri in 1916.

Di kontri break into French and di British parts, afta some years di English speaking parts join Nigeria.

But di remaining English speaking parts dey accuse di president of abandonment and exclusion from power and some militant group dey fight for di independent state.

Source