Who be Andrew Wynne why Nigeria goment declare am wanted?

Bifor Monday September 2, 2024, very few pipo for Nigeria sabi di name Andrew Martin Wynne, but by Tuesday morning di name rank number three for di top searches on Google in Nigeria.

Dis na becos di Nigeria police declare Andrew Wynne (a.k.a Andrew Povich), wey be British man, and anoda Nigerian, Lucky Ehis Obiyan, wanted sake of accuse say dem dey fund terrorism and dey incite pipo to mutiny.

Also Wynne and Obiyan name appear for di court papers wey di Nigeria goment take charge 10 pipo wey dem arrest during di ‘End Bad Governance’ protests to court on Monday.

Even though di two – Wynne and Obiyan – no follow for di accused persons for dat court matter, di goment say na dem ginger di protesters to cause katakata for Nigeria, and to dey shout “Tinubu must go, na military we want”. And according to goment, dis na offence wey amount to treason and e dey punishable unda section 97 of di penal code.

But who be Andrew Wynne?

Accountant, school teacher, book seller

Like we bin don tok, oga Andrew Wynne no be pesin of any particular interest bifor now, so nothing much bin dey known about am bifor now.

Di tins we know now about am na from wetin e tok for some interviews e get wit some Nigeria tori pipo afta di police declare am wanted.

  • E say im na accountant and financial consultant and e don work wit some state goments for Nigeria. E don dey come Nigeria since year 2000.
  • Originally from Britain, oga Wynne say im first visit to Africa na almost 50 years ago wen e bin dey teach for one Secondary school for wetin don bicom Sudan now.
  • E get bookshop – Iva Valley Books – for di second floor of di headquarter building of di Nigeria Labour Congress for Abuja, and according to am, e don dey run di bookshop for seven years
  • E dey married to a Nigerian woman, her name na Helen, and according to her, dem don know each oda for eight years bifor dem marry last year

Who be Lucky Obiyan?

  • Lucky Ehis Obiyan na from Ekpoma, Edo State. For im facebook handle, e describe imsef as “a social crusader, pathfinder, a defender of di defenceless, a politician”.
  • E follow for di pipo wey ginger di ‘End Bad Governance Protest’ wey happen across Nigeria from August 1 to 10, especially for Abuja.
  • As a politician, Obiyan bin express interest to run for di post of govnor for Edo State in August 2023. Di election go happen dis September.
  • Im na graduate of Ambrose Ali University, Ekpoma
  • For one of im video on facebook, Obiyan tok say di vision of im organisation – The African Federation (TAF) – na “di full restoration of a vibrant, united and prosperous Africa”.
  • E no dey clear weda Obiyan still dey Nigeria abi e don comot

Accuse wey police sama Wynne, Obiyan

Simon Lough, wey be senior advocate of Nigeria dey display book wey police seize for Andrew Wynne bookshop wey dem tok say e dey incite pipo to mutiny.

BBC
FG lawyer, Simon Lough (SAN) tok say oga Wynne dey sell dis book for shikini money give pipo make e radicalise dem to cause katakata for Nigeria

According to di toktok pesin of di Nigeria police, Muyiwa Adejobi, Andrew Wynne na “foreign mercenary wey don build network of sleeper cells to overthrow di Nigeria goment and put di nation for katakata”.

“Documentary evidence and confessions show say Andrew Wynne bin issue directives, monitor progress, and provide finance and operational guidance to achieve unconstitutional regime change for Nigeria,” Adejobi tok.

“E mobilise and deploy billions of naira to im Nigerian join bodi pipo, to mobilise di public to violently storm police facilities and military barracks, anticipating a bloodbath wey go instigate international condemnation of di Nigeria goment. Dis acts na clear violation of di Terrorism (Prevention) Act 2011 and oda relevant laws.”

All dis na claims wey police ddey make against Wynne.

For di Federal High Court in Abuja on Monday, afta police arraign di ten pipo wey dem arrest during di ‘End Bad Governance Protest’, lawyer to di Nigeria gomeNt, Simon Lough tok say Wynne dey sell books and oda materials wey fit “radicalise di pipo”.

Di Lawyer show one of di book wey di title na ‘Revolution na di choice of di pipo’, and e tok say Wynne dey sell di book for shikini price of 200 naira for im bookshop so dat many pipo go fit buy am.

Meanwhie, for im interview wit tori pipo, Andrew Wynne tok say im no dey fear di allegations wey police sama am, and im no go mind to go to di Nigeria High Commission for London, if di Nigeria goment invite am to come ansa questions.

But as e be now, “e dey unlikely say I go fit get visa to visit Nigeria again” e tok.

Source