NNPC increase petrol price from 617 per litre to 897 naira

BBC

Di Nigeria National Petroleum Corporation (NNPC) Ltd don review di price of Premium Motor Spirit (PMS) from 617 per litres to 897 naira.

Dis na di new informate wey don come out despite how Nigerians dey face long queues for petrol stations.

Many filling stations across Nigeria no get di product to sell, while di ones wey get dey sell at higher prices.

Dis frustration don make Nigerians to ask kwesions to know wetin dey really cause di scarcity and increase for price.

NNPC bin say di reason why fuel scarcity dey na becos say NNPC Limited dey owe big money and dis debt na sake of di supply costs of petrol wey dey affect supply sustainability.

According to di new informate wey reach BBC News Pidgin, di new upward review go take effect from Tuesday 3 September, 2024.

NNPC say make all di pump begin change dia pump price to N897 per litre.

“Dis na to inform you say NNPC retail management don approve di upward review of PMS pump price from N617 per litre to N897 effective today, 3rd September . 2024.”

“Please ensure say all your pumps and price boards dey show di new PMS price of N897 per liter.”

Why long queues show face again for fuel stations in Nigeria

Di chairman of Nigeria Union of Petroleum and Natural Gas Workers (NUPENG) don tok bifor say fuel go begin dey available for filling stations.

Tayo Adeyeji tell BBC say NNPC don solve di delay wey bin no allow dem discharge fuel for some of di vessels wey import di product.

Dis na afta long long queues bin show for some filling stations while many odas lock dia gates due to say fuel no dey available for states like Lagos, Kaduna and Rivers, and later, e begin spread to oda sates like Ogun and Nigeria.

NNPC bin assure independent marketers say dem go soon fit get supply, but di Public Relations Officer for Independent Marketers Association of Nigeria (IPMAN), Uche Ukadike say dem no get hope of getting fuel as dem no fit get access to NNPC portal wia dem dey place order for dia products.

“NNPC close dia portal sake of di challenge wey dem bin get wit wia to park di ship wey carry fuel,” im tok.

According to di kontri independent marketers, right now, Nigeria no get any inland storage or reserve at all and dis lack of backup storage follow make di scarcity worse.

Man dey hold hose to sell petrol for anoda man

BBC

Dangote begin production

Meanwhile, Africa richest man, Aliko Dangote don tok on how im local refinery go begin produce petrol per day for im facility.

Since wen dem launch di refinery for May 2023, Dangote Refinery say dem don begin dey roll out its first petrol from di facility wey dey produce 650,000 barrels per day.

Dangote say im company go tok wit NNPC to finalise how di price go be and di product go begin enta market.

“Di quality here go match wetin dey anywia for di world, we go make sure say nobody go fit beat us in terms of quality,” Dangote tok.

Dis na afta Dangote and some agencies of di Nigeria goment bin enta gbege wit each oda.

Many Nigerians get hope say wen Dangote refinery start work well well, e go fit make di price of petroleum products come down well well for di kontri.

Di initial plan be say di Nigeria goment through di NNPC suppose get 20% stake for di Dangote refinery.

However, Dangote tell tori pipo for one press conference on July 14 say “NNPC no longer get 20% stake for di Dangote refinery… dem only get a 7.2%”.

Source