Galatasaray complete signing of Napoli striker Victor Osimehn

Galatasaray don complete di signing of Victor Osimehn

Getty Images

Galatasaray don complete di signing of Victor Osimehn.

Di Napoli striker join di Turkish side on a season-long loan wey go end for June 2025.

Tori say Osimhen wan join Galatasaray come out on Monday evening – e no tey bifor all di parties complete di deal.

Di Nigerian forward bin dey also hope to comot from Napoli afta di Italian champions tell am say dem no get any plan for am dis season. Napoli sign Romelu Lukaku from Chelsea to confam dia decision.

Na Premier League Osimehn bin wan go wit tori of possible interest from Chelsea but di 25-year-old no fit reach agreement sake of di money wey di London club dey offer.

E go reunite wit former Partenopei teammate Dries Mertens for Istanbul.

Galatasaray no dey Champions League as Osimhen bin dey look for team wey go play for Europe biggest club competition.

However, di Turkish side go compete for Europa League wia dem go face Tottenham Hotspur and Ajax.

Wearing one yellow t-shirt wit scarf around im neck di Napoli striker look happy as e land for Istanbul on Monday night.

E arrive di airport to di open arms of hundreds of Galatasaray fans wey line up for road dey chant im name. Osimehn also begin chant di club anthem wit di fans.

Osimhen don dey di trend list as plenti tori about im transfer dey spread round.

E dey clear say di rumours around di signing of Osimehn na one of di big tori during di summer transfer window

For one time, Talksport report say Saudi Arabian side Al-Ahli dey optimistic to sign Napoli 25-year-old Nigeria frontman, but no be so e be.

Source