‘Na for social media I find out say my son don die’

Sub-Saharan migrants dey waka around di outskirts of Las Raices Camp for Tenerife, Canary Islands, Spain for 2023.

Getty Images
Di Canary Islands dey attractive to migrants becos dem dey part of Spain

Spain prime minister don begin crisis tok-tok wit Senegal, Mauritania and The Gambia to tackle migration.

Dis dey come as plenty young pipo dey risk dia lives as dem dey try japa through di Canary Islands.

But dis go come as small comfort to Amina.

“I find out say my son don die on social media,” she tell BBC from her house near Senegal capital.

“We always dey tok and e tell me say im wan go Morocco,” di 50-year-old mama tok.

“E no ever mention am say na boat im dey plan to take travel.”

Di last time she bin hear from her son, Yankhoba, na for January. Afta di soul-crushing, six-month search for di devoted 33-year-old tailor no yield any result.

Den, for early August, fishermen discover im body for di oda side of di Atlantic Ocean, about 18km (11 miles) off di coast of di Dominican Republic.

At least 14 deadi body wey don dey rotten bin dey on dat small wooden boat, local police tok.

Dem see mobile phones and personal documents close to di deadi body dem, wey show say most of dem bin come from Senegal, Mauritania and Mali.

Among di items on board na Yankhoba identity card.

Dominican authorities also report say dem see 12 packages wey contain drugs.

Dem dey carry out some analysis to determine di time and cause of di deaths, although dem dey reason say di passengers bin dey try to reach Canary Islands but dem lost.

Di boat dem use be like normal wooden fishing boats dem dey usually use transport illegal migrants from West Africa go Europe.

Yankhoba na im mama first child and only son. Na one position wey dey come wit great deal of responsibility for Senegalese society.

Di young tailor get wife and two young children, including one wey e no live long enough to see.

Bifor Amina know say her son don die, she bin beg for help from missing pesins pages on Facebook and she tell social media influencers wey get big followings to help her dey tok about di case.

“I bin hold on to di belief say maybe dem hold Yankhoba for prison somewia for Morocco or maybe even for Tunisia,” she tok, as her voice dey break.

Map show Senegal, Canary Islands and Dominican Republic. Migrants bin dey try to reach di Canary Islands from Senegal, but dem lost. Later dem discover dia boat off di coast of di Dominican Republic.

BBC

Young West African migrants wey dey try japa go Europe dey increasingly choose di Canary Islands route instead of di Mediterranean alternative.

Despite di dangers wey dey, e involve just one step, instead of to cross both di Sahara Desert and di Mediterranean.

Last year alone di Atlantic route see 161% increase compared to di previous year, European Union border agency, Frontex tok.

Spain na one of di European kontris wey dey receive most migrants.

As for di pipo wey dey comot Senegal, most of dem na middle-class workers wey fit afford di more expensive journey go US instead of Europe.

Dat na wetin Fallou do.

Even though e dey run successful sheep and bird farm for Dakar for almost one decade, e still dey struggle.

“I feel stuck. Apart from say I dey run my own business, I also dey work for one factory, but I still dey struggle to make ends meet,” e tok.

So at di age of 30, e sell everything wey e get and e buy one-way plane ticket go Nicaragua for Central America. From there, e go attempt di overland journey go di US.

Na Fallou older brother encourage am to leave, di elder brother already dey for America. Also di plenty fotos and videos of Senegalese pipo on TikTok wey dey share as dem dey through Central America ginger am.

“My mother bin no want make I go, but I dey ready to face death,” e tok.

Fallou bin travel for 16 days, e pass through Nicaragua, Honduras, Guatemala and Mexico, wit di help of smugglers. In total, e spend more dan $10,000 (£7,600) on di journey.

By contrast, poorer migrants wey take boat from Senegal go Canary Islands typically dey pay smugglers around $450.

Migrants from Ghana, Ivory Coast and DR Congo dey waka along di Pan-American for Honduras for June 2020. em dey on dia way to Mexico and ultimately US.

AFP
Growing numbers of African migrants dey pass through Central America

Fallou say im sacrifice come wit im own share of horrors.

“Many pipo die for my eyes,” e tok.

“But I see some women wey continue to dey push, even wit dia children for dia backs, and I think say: ‘I gatz stay strong.’”

Afta dem hold am for one US detention camp for a few days, dem later give Fallou leave to remain as asylum seeker.

E later reunite wit im brother and now e dey work as mechanic.

Fallou dey lucky, but many African migrants wey dey hustle go di US no dey dat lucky.

Last September, dem deport more dan 140 Senegalese go back house afta dem cross di Mexico-US border.

Human rights groups and diaspora communities wey dey support di new arrivals report say accommodation dey full wit pipo wey get such cases.

Some migrants no get option but to sleep on di street. Dem dey allow odas stay temporarily for mosques.

Ova di last 10 years, di UN migration body (IOM) say more dan 28,000 migrants don drown for sea.

Political promises

Narrow, canoe-style fishing boats - wey pipo sabi locally as pirogues - dey close to di shore for Saint-Louis, Senegal.

Getty Images
These wooden fishing boats – dem call pirogues – na im many Senegalese migrants wey dey try japa go Europe dey use

“People are leaving [West Africa] because they are faced with an explosive cocktail of security, institutional, nutritional, sanitary, post-Covid and environmental problems,” says immigration expert Aly Tandian.

The number of people leaving Senegal in particular is rising, despite being a relatively peaceful country with a new president who is promising to create jobs for young people.

Since the new government was elected in March, it has succeeded in reducing the price of some basic necessities, including oil, bread and rice – therefore easing the cost-of-living squeeze.

But it is not enough.

“We all thought that the hope raised by the change of regime would halt the resurgence of these migratory flows, but unfortunately this has not been the case,” says Boubacar Sèye, head of the non-government organisation, Horizon Without Borders.

“Despair and doubt have permeated our sociological environment, to the point where people no longer believe that their destiny can be fulfilled here,” he adds.

Oga Sèye don write formal letter to di Senegalese authorities, wey e beg dem to torchlight wetin happun to di boat dem see off di Dominican Republic.

E say reports show say “criminal economy wey surround these irregular migrations dey. Trafficking in drugs, arms, human beings and also organs”.

For July, afta dem discover 89 bodies for one boat off di Mauritania coast, Senegal Prime Minister Ousmane Sonko bin make public plea to young pipo say make dem no follow di dangerous Atlantic route go Europe.

“Di future of di world lie for Africa, and you, young pipo suppose know dat,” e tok.

Yet, for di large number of young Africans wey still dey risk dia lives to reach Europe and US, dat future dey anywhere but no be for home.

Source