How Somalia double car bomb blasts kill 100 pipo for di kontri capital

Somalia bomb blast

Reuters

Di two car bombs wey explode for Somalia education ministry, next to one busy market junction, kill at least 100 pipo and injure 300, President Hassan Sheikh Mohamud tok on Sunday, warning say di number of deaths fit rise.

Mogadishu K5 junction dey normally busy wit pipo buying and selling everytin from food, cloths and water to foreign currency and khat, one soft narcotic leaf, but e quiet on Sunday, wen emergency workers still dey clean blood from di streets and buildings.

Saturday attack na di deadliest since one truck bomb explode for di same junction for October 2017, killing more dan 500 pipo.

No one immediately claim responsibility, but Mohamud blame di Islamist al Qaeda-linked group al Shabaab.

Di chairman of African Union Commission, Moussa Faki Mahamat, condemn di attack and ask di international community to “redouble im efforts to make sure dem give proper international support to Somalia institutions for dia struggle to defeat terrorist groups”.

Di first of di explosion hit di education ministry around 2 p.m. Di second hit as ambulances land and pipo gada to help di victims.

Mohamed Moalim, wey get one small restaurant near di junction say im wife, Fardawsa Mohamed, mother of six, rush to go help pipo afta di first explosion.

“We fail to stop her,” im tok. “Di second blast kill her.”

President Mohamud say some of di pipo wey wound dey for serious condition and di number of deaths fit rise.

“Our pipo wey dem massacre … include mothers wit dia children for dia arms, fathers wey get medical conditions, students wey dem send go school, businessmen wey dey struggle wit di lives of dia families,” im tok afta visiting di scene.

Somalia bomb blasts

Reuters

Al Shabaab militants, wey dey try takeover goment and establish dia own rule based on extreme interpretation of Islamic law, dey always do attacks for Mogadishu and oda places. But e dey like di group not to claim responsibility for attacks wey dey result in di death of many pipo.

Wit support from di United States and allied local militias, di president don launch attack against al Shabaab, although results dey limited.

Abdullahi Aden say im friend, Ilyas Mohamed Warsame, die as im dey travel for im Keke Marwa to see im relatives before e return to im house for Britain.

“We recognise di number plate of di keke, wey don burn finish now,” Aden say.

“Tired and desperate, we find im deadi bodi for midnight last night for hospital,” im tok. “I no fit comot di image from my mind.”