Transfer window deals: Who be di biggest spenders, record breakers – all you need to know about di transfer-window breakdown

Ivan Toney/Victor Osimhen/Jadon Sancho/Raheem Sterling

Getty Images
Ivan Toney/Victor Osimhen/Jadon Sancho/Raheem Sterling

Even though di transfer window for league clubs wey dey England and Scotland don close, di transactions wey dem do plenti well-well.

Di total summer outlay by Premier League teams reach more dan £1.96bn.

According to data from Football Transfers, di Premier League spend more dan double of wetin dia nearest rival – Serie A of Italy spend.

Eight clubs from England top flight break dia transfer records, but wia di best business happun? Who do di biggest deals? And which club no spend big money?

Osimhen Chelsea move plus oda Transfer deadline day deals

Mikel Merino join Arsenal, Ugarte to Man U, footballers wey fit move bifor transfer window close?

Complete pairing of 2024/25 Europa and Uefa Conference League

How di transfer deadline day waka and di ogbonge deals?

Some top players from di league clubs

Getty Images

Na early mor-mor afta di transfer window close na im dem announce di most of di ogbonge deals.

Afta Chelsea winger Raheem Sterling join Arsenal on loan for one season, di Blues confam say dem sign Manchester United Jadon Sancho on di same arrangement.

Do two transfers bin need deal sheets – wey extend di 11pm deadline by anoda two hours – to bifor dem sign.

Dis keep fans for di edge as dem bin wait for long hours reach night to confam di deals.

England striker Ivan Toney also move late – e complete £40m move from Brentford to Saudi Pro League side Al-Ahli.

Bifor dem allowing Sancho to leave, Manchester United splash out di highest fee on di day – dem sign Paris St-Germain and Uruguay midfielder Manuel Ugarte for an initial £42.1m, wey fit rise to £50.5m afta dem add oda tins.

E make am one in and one out, for di central midfield for Manchester United .

Dem also confam say Scotland international Scott McTominay move to Serie A side Napoli for £25.7m.

For anoda place, forward Eddie Nketiah join Crystal Palace from Arsenal for deal wey worth around £30m.

Unfortunately for Chelsea, dem no fit sign any striker of dia choice as di move wey dem bin make for Napoli Victor Osimhen no work out.

Bifor di window close, Arsenal also sell dia goalkeeper Aaron Ramsdale to Southampton for £25m.

How much clubs wey dey hope to win title spend?

Record Premier League Champions Manchester City get di lowest net spending of any Premier League club for di transfer window – dem actually make a profit of £115.8m.

Dem spend £21.4m on Brazil winger Savinho, but dem also sell players like forward Julian Alvarez and defenders Joao Cancelo and Taylor Harwood-Bellis wey make dem gain well -well for di window.

In fact, none of di top three last season show face well -well for net spending.

Arsenal spend £93.9m – including £38.4m on Italy defender Riccardo Calafiori and £27.4m each for two Spanish players David Raya and Mikel Merino – but dem sell players wey worth £76.8m.

Liverpool buy midfielder Federico Chiesa and goalkeeper Giorgi Mamardashvili but dem sell players like Fabio Carvalho, Sepp van den Berg and Bobby Clark.

E mean say dem make a profit of £14.4m profit.

Manchester City, bin don win four Premier League titles bck to back. Dem dey face 115 charges of alleged breaches of di league financial rules – wey dem don deny.

Anoda busy window for Chelsea

Dis window bin busy well-well wit plenti action for Chelsea, di total outlay since Todd Boehly becom di owner for May 2022 don rise to more dan £1.3bn.

Chelsea offload more players dan wetin dem buy. Dem offload a total of 12 players and buy buy 10 but dem spend more dan £203m.

Di Blues finish wit a net spending of £46.5m – more dan 12 oda Premier League clubs.

Among di players dem sell na £35.6m deal for Conor Gallagher wit Atletico Madrid, Ian Maatsen move to Aston Villa for £38m and Romelu Lukaku join Napoli for £28.2m.

Di amount no include Belgian goalkeeper Mike Penders, wey go join Chelsea next summer for a fee around £17m, or £29m Brazilian Estevao Willian, wey go also join next season.

Brighton go big as many clubs break records

Graphics wey show how clubs spend for di transfer window

BBC
Graphics wey show how clubs spend for di transfer window

Brighton get di highest net spending for di Premier League – £153.6m from an outlay of £195.7m.

Dem pay a club record of £39.9m for Leeds’ Georginio Rutter, £29.9m for Newcastle Yankuba Minteh, and more dan £25m each of Ferdi Kadioglu, Brajan Gruda, Mats Wieffer and Ibrahim Osman.

Dem sell Billy Gilmour for £12m on deadline day, and Denis Undav for £22m earlier for di window, wey bring in some money for dem.

Newly promoted club Ipswich na im get di next highest net spending – £107.6m.

Brighton no be di only club wey break dia transfer record.

Bournemouth buy striker Evanilson for an initial £31.7m, Brentford sign Igor Thiago for £30m and Fulham buy Arsenal Emile Smith Rowe for an initial £27m.

Aston Villa, Ipswich, Nottingham Forest and Tottenham also break dia records.

Promoted clubs spend nearly £300m

Di three promoted teams dem spend money for di Premier League as dem dey try to improve dia chances to stay up and avoid relegation.

Ipswich and Southampton spend more dan £100m, while Leicester pay out more dan £75m.

Ipswich spend £109m for 10 players – seven of dem come from Premier League clubs including Chelsea Omari Hutchinson, wey join for £20m afta im loan move dey successful.

Southampton signings, wey include di deadline-day arrival of Ramsdale, come from a wider variety of divisions.

Meanwhile, Leicester City, buy exclusively from top divisions – wit four of dia seven signings wey come from Premier League and one from each of di Italian, Portuguese and Belgian leagues.

Grapics wey show how promoted clubs spend for di transfer window.

BBC
Grapics wey show how promoted clubs spend for di transfer window.

Meanwhile… £10m for League One striker One?

From di Premier League, wey waka enta League One wia Birmingham smash di League One record as dem sign Fulham striker Jay Stansfield on deadline day for more dan £10m.

Di former record for transfer for England third tier na Sunderland wey bin spend £4m to sign Will Grigg from Wigan Athletic for 2019.

E mean say Birmingham push dia total spending to £30m – dis na veri big figure for League One.

Stansfield, wey dey 21 years, return to St Andrew afta e score 12 goals on loan for Birmingham last season. E also win di win dia Player of di Year award.

Im actually score for Fulham wen dem beat Birmingham for midweek – but now im don switches sides again.

Source