Who be Johann Rupert wey overtake Aliko Dangote as di richest man for Africa

Johann Rupert

Getty Images

South African billionaire and Chairman of Richemont, Johann Rupert don become di richest pesin for Africa.

E overthrow Nigeria industrialist Aliko Dangote wey bin occupy di position for several years.

Dis na according to Bloomberg Billionaire Index (BMI) latest ranking.

BMI na one ogbonge organization wey dey always rank di world richest pipo daily. Dem declare Oga Rupert as di richest pesin for Africa afta Oga Dangote wealth reduce by ova $1 billion.

According to di latest data from BMI, Oga Rupert network now tanda at $14.3billion, and e pass dat of Dangote wey dey for $13.4billion. For di Year to date, Rupert gain $1.87 billion, while Dangote lost about $1.69bn.

Di fall for Oga Dangote wealth show di challenging economic environment for Nigeria, wia e dey primarily operate im businesses.

Since President Bola Tinubu enta office last year, e don introduce several economic reforms for Africa most populous nation, wey include di removal of fuel subsidies, wey don contribute to high inflation, wey currently dey ova 30%.

Oga Tinubu say di reforms dey necessary to cut goment spending and bring long-term growth.

Di sharp fall for di value of di naira don greatly affect Oga Dangote, wey im wealth dey largely tied to assets wey dey in local currency.

Di 66-year-old businessman make im wealth from cement and sugar industries – and last year e open one oil refinery for Nigeria economic hub, Lagos.

Im business empire, di Dangote Group, don also face plenty setbacks in recent months sake of production delays for im refinery and supply chain disruptions.

Forbes magazine for January list am as Africa richest man for di 13th year in a row despite di kontri economic difficulties.

Also, according to BMI report, dem no include Dangote $19 billion oil refinery wey e currently dey develop for Nigeria for di valuation sake of say, e no dey operational yet.

Two weeks ago, Bloomberg bin rank Dangote as di 145th richest pesin for di world, but now e don drop go di 160th position, while Johann Rupert dey for di 146th position according to dia latest ranking.

Who be Johann Rupert?

According to Bloomberg Intelligence data, di Rupert get dia wealth from Cie Financiere Richemont, one publicly traded luxury goods manufacturer and retailer, and dem be di world largest luxury watchmaker.

Di company dey best known for dia brands wey include Cartier and Montblanc.

Dem start am for 1998 through one spinoff of assets wey Rembrandt Group Limited (now Remgro Limited) own, wey im father Anton form for di 1940s.

Di billionaire dey serve as chairman for di family investment vehicle.

E study economics and company law for di University of Stellenbosch. E work for several places and for 1988, e form Richemont and become di Group Chief Executive.

Oga Rupert get honorary doctorates in Law, Economics and Commerce, e also be di Chairman of di Peace Parks Foundation and di Michelangelo Foundation.

Di billionaire na also di chairman of di South African PGA Tour, lifelong member of di European Tour, and founder of di Laureus Sport for Good Foundation, wey dey aim to help young pipo overcome poverty, homelessness, AIDS and violence through sports-related community projects.

Dem born Johann Peter Rupert for June 1, 1950, for Stellenbosch, e be di oldest son of billionaire industrialist Anton Rupert and im wife, Huberte.

Di billionaire dey live for Cape Town, wia e get one lavish mansion, but e also get properties for Geneva and London.

Oda African billionaires wey make di list

BMI also rank Nicky Oppenheimer, anoda South African billionaire, di third richest pesin for Africa, e get net worth of $11.3bn, followed by Nassef Sawiris, one Egyptian businessman, wey get fortune of $9.48bn.

South African investor Natie Kirsh complete di top five African billionaires list wit $9.22 bn.

Like Forbes, di Bloomberg ranking dey monitor daily changes for di net worth of di world wealthiest individuals.

Di title of Africa richest pesin fit continue to change hands as market conditions fluctuate and businesses navigate complex challenges.

Top ten richest pesins for di world

  • Elon musk
  • Bernald Arnault
  • Jeff Bezoz
  • Mark Zuckerberg
  • Bill Gates
  • Larry Ellison
  • Larry Page
  • Steve Ballmer
  • Warren Buffet
  • Sergey Brin

Source