Anambra INEC governorship list: Full list of candidates for Nov 6 governorship election

Nigeria election office, INEC don full list of candidates for November 6 Anambra State governorship election.

36 political parties na im dem Independent National Electoral Commission list to contest di election.

But dem no put a name for di main opposition Peoples Democratic Party [PDP] candidate.

Full Anambra INEC governorship list:

Di election referee for Nigeria also no include former Central Bank Govnor Chukwuma Soludo as di APGA party candidate.

Dem say na court order be di main reason for di decision wey concern PDP and APGA.

Meanwhile Nigeria election office, INEC don postpone physical voters registration wey go start on Monday 19 July.

Dem postpone di exercise to 26th of July, 2021

INEC say dem shift di state sake of di public holidays goment declare for Muslims to celebrate salah.

See di published list from INEC website: