Yahya Sinwar: Who be Hamas new leader?

Yahya Sinwar

EPA
Yahya Sinwar don dey serve as di leader of Hamas for Gaza since 2017

Hamas don announce a new leader to replace dia former oga kpatakpata Ismail Haniyeh wey die last week for Iran.

Di new oga na Yahya Sinwar, who bin dey lead di Hamas group for inside Gaza since 2017. Israel believe say Sinwar na di man wey plan di October 7 2023 attack for dia territory wey kill more dan 1200 Israeli pipo.

E take two days of serious meeting of Hamas oga dem for Doha, Qatar bifor dem agree on Sinwar.

One of di oga for Hamas tell BBC say during di tok, na only two names come up as pipo wey fit replace Haniyeh: Yahya Sinwar and Mohammed Hassan Darwish, wey be di head of di General Shura Council.

Sinwar win di vote by unanimous decision, and according to di oga wey tok to BBC, di decision show say Hamas no dey fear Israel.

“Shey dem kill Haniyeh, wey be flexible pesin and e dey open to solutions. Now dem go get to deal wit Sinwar and di military leadership,” di oga tok.

Who be Yahya Sinwar?

Yahya Sinwar dey regarded as one of di most extreme figures for Hamas.

E be number one for di most-wanted list for Israel and di United States of America also include im name for dia own list of international terrorists.

Dem born Yahya Sinwar for 1962 for inside di Khan Younis refugee camp for Gaza.

Na im be di founder of Hamas security service wey im name na ‘Majd’, and di group bin dey target Palestinian pipo wey dey allegedly collaborate wit Israel.

Sinwar don spend most of im life for prison for Israel. For 1988, wen Israel security pipo arrest am for di third time, one court sentence am to four life imprisonment terms.

But in 2011, e follow for di 1,027 Hamas and Palestinian prisoners wey Israel release in exchange for one of dia soldier Gilad Shalit, wey Hamas bin catch and hold hostage for more dan five years.

Nobody don see Sinwar for public since di October 7, 2023 attack for Israel. For June dis year, di US Secretary of State Antony Blinken tok say dem believe di Hamas leader dey hide “10 storeys underground” for inside Gaza.

Israel reaction

Both di Israel goment and di Israel Defence Forces (IDF) don react to di appointment of Sinwar as di new Hamas leader.

Foreign Minister Israel Katz tok say “di appointment of arch-terrorist Yahya Sinwar as di new leader of Hamas na yet anoda compelling reason to quickly eliminate am and wipe dis vile organisation from di face of di Earth”.

Also, di IDF tok tok pesin Daniel Hagari tell one news channel for Saudi Arabia say, “Yahya Sinwar na terrorist wey dey responsible for di most brutal terrorist attack in history.”

One former US National Security Council official, Javed Ali, tell BBC say Sinwar appointment fit hinder di negotiations for ceasefire and hostage release sake of say “e no too dey flexible and e dey much more difficult to negotiate wit”.

Source