Who fit replace Biden as Democratic nominee?

Joe Biden and Kamala Harris

Getty Images

Some number of Democratic lawmakers dey call on President Joe Biden to end im re-election campaign afta di debate against Republican challenger Donald Trump wey dem see say e do bad.

Na at least 30 lawmakers for di House of Representatives, three US senators and some leading donors wey include actor George Clooney don come out to also say make Biden step down.

Di fallout wey dey happun fo di party don de enta long weeks.

Prominent lawmakers like Adam Schiff – one California congressman wey dey contest to be di next senator for di state, dey ask Mr Biden make e “pass di torch” of leadership.

Wit plenti oda pressure and opinion polls since di debate don happun, na Trump dey suggested pass to get ahead for di major states.

President Biden dey insist say e go still dey for di presidential race.

E dey appear for campaign and long news conference.

As di pressure dey build-up, attention don turn to who go fit replace Biden if e change im mind not to contest- or if dem force am out of di race.

Vice-President Kamala Harris and some oda senators na im dey list of pipo wey fit replace Biden for di contest.

How dem fit replace Biden?

Na different situations fit play out for di next coming days and weeks, but na two ways dey wey go make Mr Biden campaign end.

Na if Biden pull out by imsef, or im own party force am to step aside.

Di first option dey more straightforward, but di party go need to decide di second one.

Mr Biden don win di support of almost all of di Democratic delegates wey go vote for di party convention for Chicago for August.

If Biden step down, dem go get di chance to vote for anoda candidate.

Anyone wey win majority of delegates for di convention go be di new nominee.

Di second option go come wit plenti rofor-rofor as time dey run and logistics circumstances fit make di process difficult.

Democrats dey plan to hold roll-call vote wia dem go formally elect Mr Biden as di nominee for di party bifor dem file di Ohio 7 August deadline. Dis na 12 days bifor di convention go begin.

For dose wey want make di president nomination stop, dis go be dia last opportunity to do so.

But Leah Daughtry, di chairperson of di convention rules committee, tok for one meeting say “challenger go get di verified support of hundreds of delegates” for di virtual vote to turn di process.

Dat go dey veri difficult to do.

Mr Biden win 3,896 delegates for di Democratic primary. One candidate only gatz get 1,968 to get di nomination for di first ballot, wey means say some go run comot.

“Dat kain challenge neva happun ova di past 50 years wey dem don dey do primaries,” Ms Daughtry say.

If President Biden go suspend im campaign through any of di options, who be dose wey be di leading contenders?

Vice-President Kamala Harris

Kamala Harris

Getty Images

Vice-President Kamala Harris, wey don already dey di ticket, na one obvious and popular choice within di party wey dem want make she replace Mr Biden.

As di deputy, she don become di face of campaign for dis administration to protect reproductive rights afta di Supreme Court bin overturn Roe v Wade.

Ms Harris dey prove say she be loyal pesin to di president and she dey defend im debate performance.

Afta di event, she gree say di president get “slow start” but she add say Biden provide more correct ansa dan Trump.

Days afta di debate, pipo dey concern about d president ability to hold di ticket.

Ms Harris stand for her support for Mr Biden.

“Look, Joe Biden na our nominee. We beat Trump one time and we go beat am again, period,” she tok on Tuesday.

“I dey proud to be Joe Biden running mate.”

Ms Harris get di strong name recognition wey come from di job of vice-president, but she bin struggle wit low approval ratings throughout her tenure.

Fifty-one percent of Americans no support of Ms Harris, while 37% support her, according to polling averages wey dey tracked by FiveThirtyEight.

Michigan Govnor Gretchen Whitmer

Gretchen Whitmer, Michigan Governor

Getty Images

Gretchen Whitmer na two-term govnor of Michigan, and she dey popular for di Midwest Democrat wey many pipo believe say go run for president for 2028.

She don campaign for Mr Biden in di past and she no dey shy about her political aspirations.

She tell di New York Times say she wan see Generation X president for 2028, but she stop to suggest say she fit fill dat role.

For 2022, she bin lead one campaign wey leave Michigan Democrats for control of di state lawmaker and di govnor seat.

Dat kain political control bin allow her to make some policies wey include to protect Michigan abortion access and di passage of gun safety measures.

California Govnor Gavin Newsom

California Governor Gavin Newsom

Getty Images

California Govnor Gavin Newsom na one of di strong replacement for Biden. E dey appear for cable news networks to praise Mr Biden.

But e be like say Mr Newsom get political ambitions of im own.

Im dey listed as possible 2028 candidate, but many Democratic pundits dey predict now say e fit be di stand-in for Mr Biden.

Mr Newsom raise im national profile in recent years.

Im be top substitute during Mr Biden debate for Atlanta in June, and refuse to ansa several kwesions for di room weda e go replace Mr Biden or not.

For now, im dey publicly stand by di president.

E travel go Washington to attend one Wednesday meeting wit Mr Biden and oda top Democratic govnors.

Transportation Secretary Pete Buttigieg

Transportation Secretary Pete Buttigieg

Getty Images

E no be secret say Transportation Secretary Pete Buttigieg get presidential aspirations.

E contest for president for 2020 and im dey as one of di Biden administration best communicators.

Mr Buttigieg don manage some public crises during im time as transportation secretary.

E help to oversee di goment response to di East Palestine train derailment for Ohio, di Baltimore Bridge collapse and Southwest Airlines scheduling crisis for 2022.

Pennsylvania Govnor Josh Shapiro

Pennsylvania Governor Josh Shapiro

Getty Images

Pennsylvania Govnor Josh Shapiro don get high approval ratings since dem elected am for 2022.

Di govnor, wey serve as di state attorney general bifor, don work across party lines during im tenure.

Im make national headlines last year afta e quickly rebuild one collapsed bridge for Philadelphia highway. Na major political victory for any first-term govnor.

Di speedy repair bin receive plenti hailing from pipo wey see am as di perfect infrastructure mata for any potential candidate wey wan contest for 2028 presidential election.

Illinois Govnor JB Pritzker

Illinois Governor JB Pritzker

Getty Images

JB Pritzker wey be di govnor of Illinois don raise im profile in recent years by going afta Trump and to defend Mr Biden.

Di billionaire businessman dey quick to post criticism of Trump for social media.

Afta di debate, e call Trump “liar” and say e be “34-count convicted pesin wey only care about imsef”.

Like Ms Whitmer, Mr Pritzker get track record of completing agenda items for Democrats to-do lists ontop issues like abortion rights and gun control.

Oda possible candidates dey?

Di list of potential nominees dey long beyond dis Democrats, as di party don develop list of possible future presidential candidates.

Kentucky Govnor Andy Beshear, two-term Democratic govnor for veri conservative state, don earn growing national attention since im re-election last year.

Maryland Govnor Wes Moore find imsef for di spotlight in recent months following di collapse of di Francis Scott Key Bridge for Baltimore.

Senators Amy Klobuchar and Cory Booker don contest for president for di past and get some name recognition among Democrats.

Georgia Senator Raphael Warnock, wey win one closely contested Senate race for swing state, also dey among dose wey dem mention as potential replacement for Mr Biden.

One Reuters IPSOS poll wey dem release on Tuesday find say di only pesin wey fit beat Trump for November na Michelle Obama.

But di former first lady don tok plenti times say she no get presidential aspirations.

Source