Lagos no return environmental sanitation – wetin dis exercise mean and state wey dey practice am

Lagos State goment don deny di tori wey dey fly up and down say goment don bring back di monthly Saturday environmental sanitation and e go start by ending of July, 2024.

Di State Commissioner for Environment and Water Resources, Tokunbo Wahab for one statement on im X account (former Twitter) clear am say, make pipo ignore di tori as plans no dey to re-introduce di exercise.

Recently, tori bin spread say Lagos State Executive Council don give approval for di introduction of di monthly environmental sanitation exercise.

According to di reports, di exercise go resume for di last Saturday of July and say Govnor Babajide Sanwo-Olu go officially announce am.

Dis report bin generate plenty reactions sake of say Lagos na Nigeria largest commercial city and di reintroduction of environmental sanitation go limit pipo business waka-waka.

However, di commissioner of environment don tell di pipo of di state to ignore di news and go about dia lawful business endeavour.

“No restriction of movements go dey on di last Saturday of July or any oda month for dat mata.”

WE HAVE NOT RE-INTRODUCED MONTHLY ENVIRONMENTAL SANITATION FROM JULY – LASG

#AGreaterLagosRising
#LASG

Posted by The Lagos State Government on Wednesday, July 17, 2024

Oga Wahab explain say wetin Govnor Babajide Sanwo-Olu tok na say, “Every week, dem go dey carry out weekly community based sensitisation and awareness exercise wey go involve all residents.

“Goment officials go lead from di front evri week as dem go join residents clean dia environment in a voluntary manner as dem preach di message.”

Na for November 2016, former Lagos govnor, Akinwunmi Ambode cancel di monthly environmental sanitation exercise, wey dey hold evri last Saturday of di month between 7am and 10am.

During di period of di exercise, business no dey open and motorists no dey waka anyhow.

Di den commissioner for information Steve Ayorinde wey announce di ban on di exercise bin explain say dem gatz cancel am becos Lagos don become megacity, and e no dey right to restrict movement for three hours wen pipo suppose dey run dia business.

“In di last two decades, Lagos don grow well-well into mega city and e carry huge environmental problems wey dey come wit managing a population of ova twenty million pipo.

“But sadly, di environmental laws, policies and procedures wey dey in place for di state neva fit match up wit di remarkable growth and di dream of a 24-hour economy,” Oga Ayorinde bin announce at di time.

Di ban also bin come afta Lagos State Court of Appeal rule against di monthly exercise for di state.

Di court describe am as illegal and order say make di state goment no restrict pipo movement on dat day.

Di court ruling also say make di state goment no eva limit di movement of anyone and at anytime for di state.

Wetin be environmental sanitation

Environmental sanitation na di practice of ensuring say di environment dey clean, healthy and safe.

E involve di means of maintaining clean and hygienic environment wey dey free from yamayama, germs, pollutions and organisms wey dey cause disease.

One World Health Organization report say according to di latest WASH-related burden of disease estimates, 1.4 million pipo dey die evri year sake of inadequate drinking-water, sanitation and hygiene.

Most of dis deaths na for low-and-middle-income kontris.

For 2022, 57% of di global population (4.6 billion pipo) use managed sanitation service; 33% (2.7 billion pipo) use private sanitation facilities; 21% (1.7 billion pipo) use toilets or latrines wia dem dey safely dispose poo-poo; and 88% of di world population (7.2 billion pipo) use at least basic sanitation service.

Oda states wey still dey do environmental sanitation

For Kano, na evri last Saturday of di month di pipo of di state dey carry out environmental sanitation.

Some oda states wey also dey continue wit di practice include, Bayelsa, Rivers, Delta, Edo, Adamawa, Sokoto, Osun, Imo, among odas.

Source