Tinubu approve 70,000 naira as minimum wage

President Bola Tinubu don approve 70,000 naira as di new minimum wage for Nigerian workers, wit promise say im go dey review di national minimum wage law evri three years.

E also promise to find ways to assist di private sector and di state goments to pay di money.

Di Nigerian leader announce di decision for di meeting e hold wit leaders of di organised labour unions – di Nigeria Labour Congress (NLC) and di Trade Union Congress (TUC) on Thursday, 18 July for di State House, Abuja.

Di tok-tok pesin to di president on Information and Strategy, Bayo Onanuga announce am on im X account.

President Tinubu for im Workers Day speech on 1 May, bin tok say, “Once we agree on a new minimum wage and general upward review, we go make provision for am for immediate implementation.”

Labour reactions to di new minimum wage

Bifor di meeting, labour leaders bin insist on N250,000 minimum wage.

However, afta meeting wit di president, di leaders of di organised labour unions confam say dem don accept di 70,000 naira minimum wage wey Oga Tinubu approve for Nigerian workers.

President of di Nigeria Labour Congress (NLC), Joe Ajaero tell tori pipo for di State House say, di unions don accept di offer and di reason dem accept am na sake of di oda goodies wey attach to am.

Di President of di Trade Union Congress (TUC), Festus Usifo plus oda representatives of Nigerian workers, wey attend di meeting, also agree say dem accept di offer.

Oga Usifo add say anoda reason why dem accept na becos di president promise a review evri three years as against wetin dey happun in di past.

Di labour leaders and di president bin reach agreement afta dem meet about one week ago.

Dis na afta months of back and forth between di labour unions and one tripartite committee on minimum wage wey di President set up for January, 2024.

Di committee wey dey made up of members from di federal, state governments and di Organised Private Sector bin propose 62,000 naira, but labour tanda on 250,000 naira as di new minimum wage for workers wey currently dey earn 30,000 naira as minimum wage.

Source