Wetin to know about Spain, Euro 2024 winners

Spain win Euro 2024

Getty Images
Spain na di only national team to win di Euros four times

Four gbosa for Spain for winning di 2024 European football championship.

Spain dey excellent form for Germany, dem win all seven of dia matches, score 15 goals and concede only four for di tournament.

La Roja win all seven games without playing penalties, na record for European Championship.

Dia 2-1 win ova England for di final make dem European champions for a record fourth time.

Spain na di only national team to win di Euros four times. Dem win di Euros for 1964, 2008 and 2012.

So how dem take break dis record?

Spain journey to Euro 2024 glory

Spain journey to win di title no easy at all dem do am di hard way, dem beat evri oda European nation wey don ever win World Cup bifor – Italy, Germany, France and England, plus dem beat 2018 finalists Croatia – for dia journey to glory forBerlin.

Dia winger Lamine Yamal make history by becoming di youngest player ever to appear for EURO against Croatia.

Group B winners

3-0 vs Croatia (Berlin, 15 June)

1-0 vs Italy (Gelsenkirchen, 20 June)

1-0 vs Albania (Düsseldorf, 24 June)

Round of 16

4-1 vs Georgia (Cologne, 30 June)

Quarter-final

2-1 aet vs Germany (Stuttgart, 5 July)

Semi-final

2-1 vs France (Munich, 9 July)

Final

2-1 vs England (Berlin, 10 July)

Highest goal scorer in Euro 2024

England captain Harry Kane share di Euro 2024 Golden Boot wit five oda players afta all of dem finish di tournament on three goals.

Spain Dani Olmo, Georgia Georges Mikautadze, Netherlands Cody Gakpo, Slovakia Ivan Schranz and Germany Jamal Musiala also win a share of di award.

Kane or Olmo no score for Euro 2024 final, wey Spain win 2-1.

Bifor now di organisers of Euros bin dey use assists as tie-break, dis for give Leipzig midfielder Olmo di award, but Uefa announce dis year say na only goals.

No surprise as di Spanish team collect most of di individual awards for di tournament

Rodri win di player of di tournament. Lamine Yamal win young player of di tournament. Dani Olmo share di Golden Boot. Yamal get di highest number of assists.

Dis Spanish team no too get big name stars like Iniesta and Xavi dia set.

Di team get two defenders wey go play for Saudi Arabia next season and several players from sixth-placed La Liga side Real Sociedad.

Marc Cucurella, wey no too dey play for Chelsea, end up as di tournament best left-back.

Only one player from each of Real Madrid and Barcelona bin dey Spain starting XI.

Spain coach profile

 Luis de la Fuente

Getty Images
Di 63-year-old start to manage Spain senior team since 2022

For sure dis na di peak of Luis de la Fuente career.

Di 63-year-old start to manage Spain senior team since 2022, afta im bin dey in charge of several of di current first team players for di under-19s, U21s and U23s.

Dis na im third European Championship win wit im nation – afta im bin win wit di U19s and U21s, and now di senior team.

For dat successful U19s team for 2015 Rodri dey, wey collect di best player of Euro 2024, Mikel Merino, wey score di winner against Germany for di quarter-finals, and first-choice keeper Unai Simon dey too.

Di hero of di final Oyarzabal, Merino, three-goal Olmo and regular starter Fabian Ruiz all play for di U21s final for 2019.

De la Fuente neva manage team for La Liga bifor im bin chop sack from im last club job, Alaves, afta just four months for 2011.

As a player im bin bin win Spanish Liga as a full-back wit Athletic Club.

Source