Andrea Pirlo: Juventus say bye-bye to dia manager afta one year in charge of di club

Andrea Pirlo

Getty Images

Juventus don sack Andrea Pirlo as manager after im spend just one season in charge of di Italian club.

Tori be say di 42-year-old na surprise choice to replace Maurizio Sarri last summer but under im guidance Juventus fail to win the Serie A title for di first time since 2012.

Di Turin-based club finish fourth, dem only qualify for the Champions League on di last day of di season.

Massimiliano Allegri dey expected to return for a second spell as manager.

Allegri bin dey in charge of Juventus from 2014-19, im win five successive league titles and reach di Champions League final twice. Currently im no get club.

Pirlo bin play 164 games for Juventus between 2011 and 2015 and win four Serie A titles for Turin afta im join dem from AC Milan, wia im spend most of his career and win two Champions League and two league titles.

Im also earned 116 caps for Italy and help them to win di 2006 World Cup, im retire for 2017 afta im spend two years for Major League Soccer wit New York City FC afta im leave Juventus.

Pirlo appointment as Juventus manager bin shock pipo although im win di Italian Super Cup and Coppa Italia, but e bin no dey enough to keep im job.

Statement for Juventus website say: “For di courage, di dedication, di passion wey you show every day, our thanks go to di ‘Maestro’, di coach and to Andrea, that really comes from di heart, as well as our good luck for di future that will surely be a wonderful one.”

Dis na di latest managerial move among Europe big clubs first one na Antonio Conte wey leave Inter Milan and former Lazio boss Simone Inzaghi replace am and Zinedine Zidane also leave Real Madrid.